Friendly enemies: oya my people na my tori be dis

in #npc6 years ago

I get this paddy man wer me and am don de do things togeda since. This guy na my friend for secondary school, we even later go the same university.
I know am sote....me and him popsi and mumsi come de very close.
As time de pass, dis my man come go learn saxophone,him no tel me about am.
Na oneday i come see am the blow sax,i come de intereted.i tell am say i wan buy sax too, him no answer me but later him come say mk i buy say him go teach me.
Na im i come hustle get small money carry go buy the sax , as i buy this sax na him my friend come de vex say ,i get dat kind money na im i no find am anything. Say i carry everything go buy sax.
Omo d guy no come teach me d saxophone again o, na him i jeje carry d sax go keep one place till wen i go see anoda person to teach me.
Till today d sax still de my room and e don de rust already. D money wer i spend don go,so make we de careful sha cos some kind friends de very greedy.download-22.jpg

Sort:  

Abi.. some kind friends sha!
Buh, u fit still teach yoursef if you really wan sabi blow sax. Enuff materials dey online and once you start you go meet people wey go wan teach you.

The magic is starting. 🖒

Perharbs e go pain that your friend well well to see say you don dey learn the sax by yoursef.

No wahala, i go try am, althogh i don tire sha

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.030
BTC 61599.36
ETH 3407.97
USDT 1.00
SBD 2.47