NIGERIA PIDGIN CONTEST......... #WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME

in #npc7 years ago

Gozie 20171127_083017.jpg

Na yesterday Na im me and my padi @frank4jesus dey discuss . Im come tell me about the contest wey our madam at the the top @ogoowinner dey organise. E pain me say I no follow for the first one but I come talk say this one no go escape me.

Friendly enemy Na im oyibo people call

wolf in sheep's clothing
.

On a norma, I no be persin wey dey too get friends like that but e get this boy wey dat time e be like say dem tie our matter for heaven.

Na so me and dis boy come become padi-padi. Anytime wey I need anything the boy go help me. Im be my personal adviser.

So one day my papa come help me apply for scholarship so I go go obodo-oyibo (America ) go do university.

Na so I come tell this my padi (uche) about the scholarship. Im come dey discourage me say all dose scholarship Na scam.

Wen the exam day reach , I go write the exam. Two weeks later the result come out e come be say I pass the exam. All Wetin remain Na make I bring my waec result and other documents.

When we come day write last paper for watching, uche wey I tink say Na my padicome sit down beside me.

As the invigilator come dey Waka come my side uche carry mgbo ( a small paper in which answers have been written on) throw for where I sit-don, come dey shout say I dey do expo.

Na so dem pursue me comot for the exam. By the time results comot, e come be say dem seize my result because of malpractice.

My people Na so I miss the chance to go study obodo-oyibo (America). Na im I come write gce, buy jamb form come apply for university of Nigeria (unn).

Now, I dey 300l ,dey study banking and finance for unn while uche don relocate go village.

Wetin uche do pain me but then Na God sabi pass.

Na picture of me for federal Palace Hotel for Lagos Na im I upload.

My username Na @molokwu una well done o.

Sort:  

Haba.. Why UChe come wicked laidat na. As I been dey reason this tori wey you yarn so. Be like say na tru true Uche do you this strong thing for we world wey we dey

My broda Na true story o. But God dey

Osanobua!!!!!! Where Uche dey now make I arrange boys wey go kolobi sense enter hin head

Lol. Na village im dey now. I don leave im matter for God since

Na God sabi pass.

The @OriginalWorks bot has checked the text of this post and it appears original!

ezgif.com-resize.gif

To call @OriginalWorks, simply reply to any post with @originalworks or !originalworks in your message!

Please note that this is a BETA version. Feel free to leave a reply if you feel this is an error to help improve accuracy. Please note, it only checks the text component!

Congratulations @molokwu! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes
Award for the number of comments

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 55994.69
ETH 2375.77
USDT 1.00
SBD 2.31