Naija pidgin challenge: My creed in Life, thanks @ogoowinner

in #npc7 years ago

Me believe say all of suppose de seen, suppose de heard when we talk

I dey sure say everybody dey equal

So me go tell anybody wey ask say, I be human being before I be any other thing.

I go run matters with people as I want make them take run matters with me.
I no go run shows wey go make my fellow man suffer or die.

I go dey try reason wetin dey sup for people dem side I no go reason say dem nuh geh sense.

i no go do you aspa the kin person wey you be but the kin person wey i want make you become for future

i no go put my hand for any package wey put anybody for wahala

i go dey put myself for pesin position make i know how them dey feel,i no go judge them

I go try show people love

I go try de with people without quarrel

I go try de give to people wer no get

I believe say one day things go better for we humans

Na me @medins make this pledge and i promise to do am. image

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 59114.57
ETH 2309.50
USDT 1.00
SBD 2.49