My Life creed : Naija pidgin challenge organise by @ogoowinners

in #npc7 years ago

I belive say every human being get the right for people to see dem, hear wetin dem dey yarn and to recive love from another person.

I dey sure say everybody dey equal

I know say rich man and poor man na wetin this ovasabi men dem wey don go front for life dey use take control people and make them misbehave. So me go tell anybody wey ask say, I be human being before I be any other thing.

I go run matters with people as I want make them take run matters with me.
I no go run shows wey go make my fellow man suffer or die.

I go dey try reason wetin dey sup for people dem side I no go reason say dem nuh geh sense.

i no go do you aspa the kin person wey you be but the kin person wey i want make you become for future

i no go put my hand for any package wey put anybody for wahala

i go dey put myself for pesin position make i know how them dey feel,i no go judge them

I go try show people love

I go try de with people without quarrel

I go try de give to people wer no get

I believe say one day things go better for we humans

Na me @medins make this pledge and i promise to do am. image

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58949.08
ETH 2306.78
USDT 1.00
SBD 2.47