The creed of life: NPC organise by @ ogoowinner

in #npc6 years ago

I believe'am say everybody get right make people see'am, hear'am and love'am.

I believe say everybody na the same thing. Nobody big pass anoda person
I know say as this world be so, e big well well ooo. E dey big sotey e fit contain all of us wella.

I believe say every single person, get im own sense and im get him own brain way him dey take reason wella, even if an one area of life.

I believe say everybody tanda well well for their own way

believe say everybody get am for angel and demon;so I go chase the demon comot,welcome the angel.

I believe say all dis race, religion and social status no be anytin, na all these people wey wan cause wahala create am make dem use dey control other people, dey cause trouble, and to dey show people say i pass you. So me choose to be "pesin first" before any race,religion abi class.

I no go allow anybody abi anything make hin come control my thinking abi my decisions

I no go react to people base on wu dey be, but wetin I want make una them become.

I no go join hand for any project wey fit destroy others life.

before i die comot this earth, make God help me, i go make sure say i do one better thing for life. Way be say my name go ring bell.

I go try make me stand gidigba, make me take heart if any kasala, yhawa or bad thing happen.

I no.go de make fear de push me to do wetin i no wan do

make i de help person de very important

make i de forgive person and forget everytime

make i de love person wit my full mind na hin sure pass

believe say peace, love, joy, and better things fit happen if all of us put hand together.

I believe say better people must win.

I don decide say i go live life wella, i no go be zombie.

Me wer my name na medinho must to follow this yarn wella.

As i don write am here, i go dey try to follow am, because i know say anything wen person dey t


alk all thr time, small small e go begin dey happen
image.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.030
BTC 61599.36
ETH 3407.97
USDT 1.00
SBD 2.47