Naija pidgin challenge: Friendly enemies

in #npc6 years ago

Na my entry be this for this topic ,thanks @ogoowinner .You too much
FB_IMG_1504429895267.jpg
Okay, mk i follow chook mouth for this mata cos me sef don tire for all this yama yama friends them wer go de laugh with you for front, sell you for back.
My own tori Na about my father friend wer him and am don be friend since wen dem small.
Dem de into the same line of Buisness and Na all this contract staff dem be.
So one day my popsi jam this big contract wer suppose yield better money.
But him no been get complete papers to take win the contract but this him friend been get the link wer him for use help my popman to do the paper sharpaly.
My father come go tell am about the contract and him come promise to help am. After my father don wait for like 2 months him no hear anything from am. Na him my dad come go the company to beg make them give am small time make him for take arrange the papers .
As him reach, na him de company tell am say them don already award the contract and "lo and behold" na this my father close friend them award the contract to.
Na him my popsi come vex call him friend to ask am why him go do am that kind thing, d guy no gree pick the call o and wen my dad finally go him house go ask am why, him tel my popsi say him no sabi say popsi bn still de interested Na why him bn accept the contract.
My people Na since dat the day their friendship waka o. Ever since then pop man come de advice us make we de careful of friend wer we de keep o. Cos some friends Na real wolf wer de wear sheep cloth.

Thanks @ogoowinner as u give me this opportunity to take share my story.

Sort:  

This wonderful post has received a @medinho 4.15% upvote from @anadolu. Discord Channel: https://discord.gg/WVJW7AC You can vote in the name of the odl. https://steemit.com/~witnesses

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.028
BTC 65156.13
ETH 3530.38
USDT 1.00
SBD 2.48