THE CREED OF LIFE - Naija Pidgin Challenge #3

in #npc6 years ago

Thank madam @ogoowinner for this oppurtunity we you don give me to personalize better and positive thing for myself

na my ogbonke translation be this

I believe sey everybody don reach to hear and love each other

I believe say every one na de same, nobody better pass another person at all

I believe sey this world big reach to contain we all

I believe sey everyone na king for him own side

I believe sey everybody dey unique

I believe sey everybody get him ganja and purewater side inside body. Me go make sure say the ganja side no show

I believe say where person come from, where him de worship and him position for society, dem just carry am for front to carry repress for society. As i de so, i go be human being first and i no go allow, tribe, religion or class determine how i go treat people

I go treat people the way i want make them treat me

I no go carry people based on who them be now, but wetin and where dem go be later in life

I no go put hand for business or anything wey go put dirt for person face

I go make sure sey i understand other people

I no go allow bad belle control me at all at all

Before i leave this world, i go do big and better better thing keep for ground

I no go allow negativity weak me

I no go allow fear-fear catch cos fear fear man no de drive motor

Me no go allow bad things flow for inside my mind, but i go make sure say better things go de

I go make sure sey i live original life

I no sey if i put my mind do something, better go comot from inside

I no go allow person carry me run anyhow race, i no get that time, i go do my things slow and steadily make i for see results

I believe sey we suppose live peaceful life

I believe say, if we get pass another person, we for de give

I no believe sey we suppose to the carry other people for mind

I believe sey we suppose love other people like ourselves

I believe sey we suppose get mercy give others

I believe sey person no suppose do another person bad waka without justifiable reward

I believe as we de live so for this world

I don gree for myself sey i go enjoy this life wey i de live so, no be to come waka pass like tree

I Patience Friday Aniekan don gree to follow this creed until when my time reach to leave this world

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 60833.36
ETH 3370.32
USDT 1.00
SBD 2.49