NPC: The Creed of Life

in #npc6 years ago

As i enter steemit, na him i see dis contest, i con say make i do my own too.

Make i thank madam @ogoowinner as na she dey organized this contest. Na i picture i put for down so.

Ogoo 20180130_011930.jpg

I believe everyone has the right to be seen, heard and loved.
Me believe say all of us dey free to yarn as we like, hear wetin we like and love who we like.

I believe all humans are equal.
Me believe say everybody for this life na same.

I believe the world is big enough to accommodate everyone.
Me believe say dis world big to contain all of us.

I believe everyone is a genius in at least one area of life.
Me con still get the believe say all of us go get at least one thing wey we sabi well well.

I believe everyone is special and unique.
Me believe say all of us dey special and as our face take different, na so we sef dey different.

I believe everyone has a beast and an angel inside of them. So I will try my best to tame the beast and arouse the angel.
Me believe say for inside all of us, d side wey no good dey and d side wey good still dey, but me go try to dey do so so good till i drive d bad side comot for my body.

I believe race, religion and social status are nothing but the creation of contentious men in order to control others, cause strife and in-plant the supremacy mentality. So I choose to be "human first" before I am of any race, religion or class.
Me believe say race o, religion o and social status, dem no exist, na we we just dey do ourselves, cos some people wan dey claim oga, but me don decide say before I go think of all those things, i go first reason like human being.

I will treat people as I will like to have them treat me.
I go dey do for people as i wan make dem do for me.

I will not react to people based on who they are, but who I will want them to become.
Me no go follow as person be follow am relate, but na wetin i wan make dem be na him i go dey look.

I will partake in no business or project that will cause harm to another person.
Me no go do wetin go cause wahala for another person.

I will strive to understand people and not judge them.
Me go do my best toh dey understand people, i no go judge dem.

I will not allow envy, jealousy and greed to control my motives.
Me no go allow bad belle, jealousy or greedi greedi to dey control me.

I will accomplish at least one notable thing for humanity before I leave this earth.
Me do must do one thing wey go shake d world for good before i die.

I will try my best to remain strong in the face of misfortune, grieves and sorrows
Me go do my best so I go fit dey strong even when i face wahala and katakata.

I will not allow fear to intimidate me.
Me no go allow fear to dey hold me for ground.

I will not allow any negative thought to occupy my mind; I will replace them immediately with peaceful and creative thoughts as soon as they come up because I know "thoughts are powerful".
Me no do allow bad bad thinking oo, na so so good good things i go dey think and when bad thinking come i go purse am with good thinking, cos i no say to think dey powerful.

I will always be me, my original self and no photocopy of another.
Me no dey to dey copy another person oo, i go be myself.

I believe I can make a difference if I put in my best to any task
Me believe say i fit to do better things, if i put my mind.

I believe life is a journey and not a race, so I will not permit myself to go into competition with anybody.
Me believe say dis life no be who carry first, all of us just dey do our own, everybody dey him own lane.

I believe in peace
Me get believe for peace

I believe in charity.
Me get believe for charity

I believe in forgiveness.
Me get believe for forgiveness

I believe in love.
Me get believe for love

I believe in mercy.
Me get believe for mercy

I believe in justice for all.
Me get believe for justice

I believe in human race.
Me get believe for human race

I make the decision to "live" and not merely "exist".
Me don make up my mind say i no go just dey inside dis world like that, i go must do something wey people go take know say i dey.

I............(your name) will abide by this creed all the days of my life.
Me Oluwaseun Osayande go follow all this creed wey i don talk about, i go follow am till i comot dis world.

I thank you say you come read my post oo, God go bless, and if e sweet your mind make you upvote am too, God go double the blessings

unnamed.gif

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 69618.00
ETH 3376.33
USDT 1.00
SBD 2.76