NIGERIA PIDGIN CONTEST.......#Wetin friendly enemy Don do me

in #npc7 years ago (edited)

images(6).jpg

My people my people, no vex say my own entry dey enta dying minute Na today Na im I hear if this contest from my padi @molokwu. I wan also thank @ogoowinner wey carry dis kain beta thing come for we people.

Na three years now, that Na 2015 wey I get my own experience.

My padi of 8 years kola ( yes Na Yoruba boy), our two Na im start to dey hustle together from day one.

After we finish secondary school, we start boutique business (Na one small shop wey we dey sell cloth) we carry all our savings put for that business dey hope say one day, we fu o start to dey import.

Two years later, our shop Don grow. Na we come dey supply give some oda people wey dey dem local areas.

But where wahala start Na when I notice say kola Don dey spend money anyhow and goods don dey miss for shop. I come ask kola im come dey vex say why I go dey accuse am.

By the year 2015 after I don pass jamb, I come travel go post-utme for enugu leave behind the shop for kola to manage till I come back.

Two days na im I don stay for enugu come see say kola no dey gree pick my calls. Me think say dem don thief im phone, na when I enter back Lagos reach our house come see my bags and clothes downstairs.

Na so I vex enter landlord house because I know say I don give kola money for rent but landlord come dey talk say kola no give am anything and im no dey see kola again.

I come carry my last money enter motorcycle go our shop. When I reach our shop Na one woman I see for there dey sell drinks. (Na small market dey d shop). I nearly run mad, Na d woman come dey explain say e don tey wey kola sell the shop give her.

Say Na last week kola pack commot the shop. Na she come give me kola new number. Wen I call kola im pick the call Wen he hear my voice, he cut the call.

My people Na there I think say my life for don end but God pass dem. Now I dey 3rd year for university by next year I go don graduate. As for kola, only God know where im dey or Wetin im use the money do.

Na picture of my school library Na Im I upload. ( university of Nigeria nsukka)

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 66066.52
ETH 3291.81
USDT 1.00
SBD 2.70