Making the Steem social network better by @ogoowinner, NPC : The block and delete button

in #npc7 years ago

My country pipu o,i hail u na o, @ogoowinner don come back with another ogbonge contest,wey she call am Naija pidgin contest.
i wan yarn u about block and delete button, before i start to yarn you my tori ,make i first jump enter the block button matter,una no sey d place wey sweet thing dey happen, bad pipu wey dem send cum from villa go one put head spoil am. Me wey write post for two hours,i cun post am finish,na e one werey pipu wan cum comment yamayama for their,or make e dey tell me say my post no dey ginger am,why e go ginger you? e resemble igbo ni....and many wahalas dem wey dem dey cause....if tosey d block button dey so...me no go think am twice,i go block all e generation dem,dem go no say man dey hot no be mans not hot
@ogoowinner if dem fit do this one for me I go blow Dem kiss wey big pass Nigeria.
d second matter about the delete button,this one too fo help pipu like me sef because sometimes ehn,wen i don write a post,if i don post am finish and me no gbadun am well like d good ones wey sabi atract my pipu dem,e go dey do me sey make i delete am but the botton bo dey for am,if tosey d button dey so,i go just delete am kiakia before dem shook eye for the matter.......i dey sure sey all of we na wey dey steemit go gbadun d block and delete button wella.
StSBf4_uriw.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 58474.85
ETH 2500.10
USDT 1.00
SBD 2.39