AS E DEY HAPPEN

in #npc7 years ago

Something dey happen here right now
Na how the matter take hit me I wan yan una so.

Una know say election na next year and na we wey be youth our politicians dey carry do all the yeye jobs. Na we be the future of Nigeria but how we go fit do anything when we dey allow our old papa dem push us anyhow?

Well o madam, As the matter don be na so it go they continue, but if need suppose be for another change for this una country no be one old papa go come announce am, na from una family, peer group ,social media, the change go start from even if possible, this steemit platform self.. If not d magnitude wey d condition go take worst no be small and na d youth dem go still contunue dey use.

Now make we talk how the main matter go take be.

As our president Gen, Muhammadu Buhari take dey lead us so, una like am?

As I take dey yarn you so and I go still dey talk am say 'to be a leader is not easy' I no fit blame blame his presidency because na vote carry him there no be say one person come nominate am, he worked for it but the God and gods no dey by im side.
The president don try but the problem be say im too far from our expectations

Wetin be the thing we him dey do wey una like?

I go still dey talk am say 'to lead a set of cunny and corrupt people no dey easy' .
Ever since he don come, everything don dey rise but I still throway salute give him for the train and railway wey im do includung the hajj fee wey im subsidize

Wetin him dey do wey una no like?

Our leader, fit be adamant, the thing wey I no like be say he increase petrol cost wey oppose im promises, and the second the be say he no dey respond to fulani herdman problems.

Wetin be the advice wey una fit give am to help our naija better?

The only ogbonge advice wey dey my be mind be say make im go team up wit his party leader, bcos restructuring naija no be one man job.

Wetin be the way forward for our youth of naija?

Way forward wey dey for the youths concerning politics be say make una dey politically oriented + active parcipation. One saying wey talk say 'only the youth can do it' I just want make dem know say u no fit know the taste of a soup by it aroma.

If a fellow youth say him wan contest una go gree vote for the person? Because I don dey warm up o! Lol!

I go vote for am only if he played his game mature and wisely
Because wey dey yarn since morning, na honourable i be for ma department, and ev'rytin wey dey na all about permutation.
@ogoowinner if u play ur game wella I go surely vote you
Because all this challenge wey una dey do don turn u to a leader already
Thanks for reading25009028_579328215744408_5417628058767065088_n.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 58474.85
ETH 2500.10
USDT 1.00
SBD 2.39