First Entry...NIGERIA PIDGIN CONTEST. #WETIN FRIENDLY ENEMIES DO MEsteemCreated with Sketch.

in #npc7 years ago (edited)

Omo naija dem, Me i dey hail o
This one go be my first time to dey follow una yans for this npc contest,
I hear say na @ogoowinner na ein arrange am for us like say na ewa goin
omo i no go lie you , when i hear this one eh my body sweet me special
Ah ahn
everytine person wan post for steemit naso ein go dey open dictionary like say tomorrow no dey
Shuu, make we dey blow our warri abeg...me i don tire to dey blow gramma `
so back to d mata wey carry me come here..

WETIN FRIENDLY ENEMIES DON DO ME
the truth of d mata be say no be me ein do, na my cousin but d tin really touch me

black-men-jail.jpg

Last year na ein i dey for ebuka house dey play pes 13(na my favourite be dat) na so kelvin enter, i no really sabi am but kelvin na buks (ebuka) no 1 padi since secondary school.
omo d boy bring ein phone tell buks say im wan sell am make buks epp am find buyer.
buks ask am why ein wan sell ein phone na say d phone make still sense na but kelvin talk say ein need money
as a hustler na ein buks finally sell the phone, collect im small cut come give kelvin the remaining money

One week afta na ein eke show o...grab buks dey ask am about the phone so ein come explain as e take sup. na ein dem call kelvin dey ask am
korokoro for my eyes kelvin deny say im no give my guy any phone , say dem never see since d previous week
Buks no fit believe am, me i shock because i dey there when e happen pesin no tell me this one

The parents of the pesin wey actually get d phone get money, naso dem carry buks throw for jail o...
for something wey ein no do..ein mama don cry tire... money no dey
my guy don dey there for 8 months, As Baba God go answer our prayers, ein follow for d 400 prisoners wey dem release because of say space no dey prison again.

I just really dey thank God say ein don come back if not for anthing at least for ein mama...
That woman suffer no be small
People wicked o
make una dey careful
Na your friend go do you the worst

and like i dey always dey tell pepo

(NTA)! No Trust Anybody!!!

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 57027.00
ETH 2353.59
USDT 1.00
SBD 2.38