NAIJA PIDGIN CHALLENGE; FRIENDLY ENEMIES

in #npc7 years ago

My people I dey greet ooo....I say make I share my own experience for this 9ja pidgin contest.Screenshot_20180126-115825_1516964359571.jpg
When i been start to dey arrange cloths .....eeh get one of tight nigger like that wey we don be friends from childhood, him name na emeka. Emeka sister haoma been wan marry that time,So emeka com give me the contract to sew the native cloth( etibo) for himself and him 5 brothers for the traditional wedding.
As per my guy na, I no been even ask for part payment 1st,i just start work, infact when I bill am, na so we cut cut so tey my gain no even been reach 1sbd again.
So one week after I don start work and 1 week too to the wedding, I call emeka for money, na so him just tidy me 5k first out of a supposed bill of 50k...I no still complain but I been bone my face sha...
So for the rest of that week, I no hear from emeka again until the Friday evening to the Saturday of the wedding, na so him call me for phone, say I make I sorry say him never call, say make I send am my account no and say him go send somebody to come pick up the cloths cos the wedding na d next morning.
So I agree.
Like five days later, I never hear from emeka, so I been just assume say him too dey do honeymoon with him sister haoma and her husband.On the sixth day, na soo the tailor wey I give to help me sew the cloth com dey worry me, as per say the tailor na my guy wey ney fail to deliver before( unlike our normal 9ja tailors), so I carry my money settle half of the payment, make I no com be the black sheepWhere me and my tailor dey.
After like one week I come waka go see emeka, him come dey yarn me say him been dey transfer d cash and d tin be dey bounce back( I com dey wonder how I take resemble mumu for him eye), so him com assure me say make I no worry say him go withdraw come give me.FB_IMG_15169615550997443.jpg
For my tailor side, I been get another work, so I been gat settle my former debt before him go do dis one, so I use my money settle d rest.
I wait for emeka and the ATM tire.After like one week, I call am him no dey pick, sometimes I use another phone call am him go pick, when him relate say na me, him go dey form like say network bad.
Den i remembered the words of my mother " sometimes your closet friends could be your greatest enemies"..
So my ppl na so eeh happen oo how man go do na...
We continue to hustle na and d big lesson I learn be say;Screenshot_20180126-115715_1516964392495.jpgScreenshot_20180126-115547_1516964413715.jpg
Na so my own gist go oo...abeg help me upvote resteem Twale @ogoowinner for this better contest wey she arrange

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 67982.33
ETH 2624.89
USDT 1.00
SBD 2.68