My creed of life : npc, episode 3

in #npc7 years ago (edited)

unnamed (4).jpg
Image source

The picture above is the beautiful and delectable Nollywood actress Mercy Aigbe..

Thanks once again to @ogoowinner who has started a movement which helps in strengthening us Nigerians by speaking our "broken english" and is somehow encouraging world peace whether directly or indirectly while at it....
I celebrate you big time @ogoowinner...

So dis na my creed
I believe in myself, say i get right to be seen heard and loved..

I believe say all of us equal sake of say, we all na human being

I believe say this world big enough to contain everybody just like sky dey enough for birds to fly....

I believe say i be genius for at least one aspect of my life

I believe say i dey special and nobody fit be like me....

I go treat people same say wey i want make dem treat me

I no go look people with small eye, instead i go look them with how dem go be for future with respect .....

I no go cause trouble for people around me....

I go try to show understanding, so teeeyy... I no go dey judge people based on wetin i hear about dem...

I no go let jealousi and greed to dey control me anyhow..

Before i commot for this life.. I just do sometin wey people go remember me for..

I go try my best to stand gidigba even when wahala wan show face...

I no go allow make fear hook me.....

I no go give bad bad tinking any chance for my life, instead i go dey reason tins wey make sense and fit add value because i know say this our mind dey very powerful...

I no go dey form like person wey no fit swallow eba...
Anywhere wey i dey, i go rep naija 100%....

I believe say if i chook my mind inside all dis mata wey i dey yarn since morning.. I go fit do beta....

I believe say dis life na like journey o, so i no go enta d same trouser with my neighbour..
Na "every mallam wit hin kettle"

I believe in peace, no be to dey cause trouble abi war for my fellow country people...

I believe in charity; to dey give even to the less priviledged...

I believe in forgiveness; make i dey quick forgive d people wey offend me....

I believe in love, make i dey show love to even my friendly enemies...

I believe to dey show mercy...

I believe say everybody deserve justice.

I believe in the life wey we dey live so...

Today, i dey choose to "live" life well, not like person wey come mark register for this life....

I @kingernie go abide by this creed all the days of my life...
So help me God 🙋

Sort:  

Lol, nice one dear...lemme go and construct my own creed too

Lolz...
Thanks

Awwwww
My creed is coming up soon

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 64409.17
ETH 2631.52
USDT 1.00
SBD 2.79