Friendly Enemies: Na im be the koko wey we dey on top today

in #npc6 years ago (edited)


My beta people, I greet una well well o. How una dey.
I don come today make I chop for this mata as I hear say na im dey cook for inside kitchen now.
Before I begin dey yarn, make I hail that beta Aunty wey come up with this ogbonge naija pidgin contest idea. That pesin na @ogoowinner. Tell her say I troway salute.

Ok, Onto the mata. I don see things for this life wey I come. This thing wey dem call friendly enemies na sometin wey I don witness myself.
Make I tell una small tory.
Man don suffer, but if I yarn you, you no go believe. I grow up for one rough street. Street wey dem dey use igbo (weed) coke jollof rice. I been get padi dem wey I grow up with for that street. We bin dey around 5 and I no lie if I tell you say na them help me survive all the cult boys and theives wey for don kill me, cos me no bin dey hear word.
All of us bin get plans of how we go make am. And we come promise ourselves say we go watch out for one another. The kine trust we I come get for them come pass the one wey I get for my fada for church.
Many years come waka, all of us come separate dey hussle, make we see food chop.
Me come enter school dey see if I go make am there.
E get one of our guy we dem dey call Kizito wey been comot go Malay. E no tey Kizi blow come make plenty money. All of us (na later I come know no be all of us) come dey happy, like pikin wey dey buy christmas clothe say our guy don make am.
That year december, all of us jam for street. We make noise that day till all papa and mama wey dey live for the area start to vex for us.
For our mind we bin dey make noise to shame our enemies but we no know say the real enemy dey our midst.
That fateful day, on the 23rd of december, Kizito carry us for im pathfinder jeep go one big club make we jolly.
We dey there drink till our eye dirty, wen e come dey pass midnight, Kizi carry us go drop for our different houses.
The next morning I hear say Kizi dey sick. I rush go im house, I see my man dey vomit blood. Me and my guy Ebuka, come help im papa put am for car go hopital. E no tey Kizi belle don swell. Before we dey know wetin dey happen, Kizi don die.

I standa where I dey, cold enta my body. My man Kizi just go like that. That day I cry like small pikin. I look up, I look down, but I no fit believe my eyes. Na one of us wey bin comot that night put poison for Kizi drink. Till today I no know who I fit trust. If one of my friends fit do this then this world fear me.
My people I don talk my own. No trust any pesin with your life. If you dey drink hold your bottle well. Na who know man dey kill man.
Make I leave am here.
Make all of una weekend sweet una paulina paulina. Bye bye.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.14
JST 0.029
BTC 58098.46
ETH 3134.93
USDT 1.00
SBD 2.38