Naija Pigin Challenge: Wetin friendly enemy don do me.

in #npc7 years ago (edited)

image

Rush hour boarding of train @ Agege, Lagos

I salute my ogbonge madam @ogoowinner for this confirm opportunity to express our tory on top language wey we sabi well.

For this life, na person wey sabi us fit do us bad pass because na dem Don enter us well.

As I see this topic, I just dey boil because e make me remember watin happen for my family of recent.

Person wey we call pastor, na im cause kata inside my family wey make my papa and mama fight.
As all of us understand say na women sabi go church pass and na women dem fit brainwash pass.

This pastor na person wey dey very close to our family and because na pastor him be, person no fit confront am tell am say watin him dey do dey wrong because him be man of God (called or not)

The pastor brainwash my mama then ehn... Collect money for her hand and give her big position for church, advice her say make she divorce her husband because the man na bad person and she just dey do everything like mumu..
I believe say na juju him use for her because all these time, all of us wey tell her say the pastor na bad person become her enemy.

The day wey God catch am na when he wan rape my mama during personal prayer session with her. She scream for help and people ask wetin happen she con explain and na that day the charm wey he use on top her clear. She con realise say he don brainwash her all these while.
She con go dey beg everyone wey she don offend during the period of the brainwash.
Na all these kind pastor dey currupt good ones and na this kind pastor dey make people no believe say original pastor dey.

The tory long pass this o but since the rule bi say make e no pass 100 words, I just summarise am.

image source



You may also view my other post

Tale of an African child
Family Love
That Somebody is No Body
When I die
Watin make Steemit dey sweet my belle





Sort:  

Amazing bro... Upvote me too @ajadudraws

Touching post bro nice one

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 61986.52
ETH 2406.81
USDT 1.00
SBD 2.65