The Creed Of Life. NPC #3

in #npc7 years ago (edited)

So this title is in Nigerian pidgin and translates to "the creed of life, how life is meant to be lived"

It's supposed to be an entry for the #npc by @ogoowinner but while writing, I discovered this post meant so much more to me than just being a contest entry.

"I practice the non-aggression principle towards all sentient beings." - @teamsteem

So my steemit sugar mummy, the ever beautiful @ogoowinner, don give us another chance say make we yarn some serious matters for this ground.


Our people say all fingers no dey equal no mean say each finger no get function.


  • I believe say all human being them be the same no matter where dem from.
  • I believe say nobody holy pass and I go try make I no let the bad part of me win.
  • I sure say everybody get him own thing wet make am be oga for him own lane.
  • I know say rich man and poor man na wetin this ovasabi men dem wey don go front for life dey use take control people and make them misbehave. So me go tell anybody wey ask say, I be human being before I be any other thing.
  • I go run matters with people as I want make them take run matters with me.
  • I no go run shows wey go make my fellow man suffer or die.
  • I go dey try reason wetin dey sup for people dem side I no go reason say dem nuh geh sense.
  • I nuh go think bad thing, and I go make sure say I run one better matters wey e be say when I don dead, people go use am dey remember me steady.
  • I nuh go downgrade myself based on another person levels, I know say my head and him head nuh carry the same oil.
  • I nuh go use another person ruler take measure myself, because everybody get e own time.
  • I nuh go use the things wey make sense for my life take joke, I go treat them like egg because life nuh go make sense if them nuh dey.
  • I go enjoy every moment wey I use my eyes take see, because yesterday own Don pass and tomorrow own still far.
  • I nuh go throway face when I still get chance to make the matter set.
  • I nuh go downgrade like say I sabi pass all but I go ready learn from and work with people wey sabi.
  • I know say life na journey nuh be race, so I nuh go run another man race and I nuh go let another man pikin run my race.
  • I believe say make everywhere good for everybody.
  • I believe say if guy man offend you and e apologize, make you let am slide.
  • I believe say make man no oppress man.
  • I choose to make sense with my life nuh be to just waka come waka go.

Me, Bros J, go dey well dey try do all these matters wey I don talk for up so till I waka comot for the world.

I believe in humanity so much, I believe there's still salvation for the worst man..
I want life to be better for me, for my unborn kids and I'd daily contribute my quota of love to humanity till I die.
IMG_20180126_125439.jpg
Thank you @ogoowinner for this timely reminder that humanity needs saving and that salvation can only come through each and every one of us.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.031
BTC 59013.49
ETH 2516.64
USDT 1.00
SBD 2.48