Wetyn Friendly Enemy Don Use My Eyes See "@ogoowinner Challenge"

in #npc7 years ago

Before I shook mouth enter my torí, abeg make una helep me troway 3 gbosa for @ogoowinner for say she think dis kain topic say make we folo talk about am "gbosa gbosa gbosa".

download (4).jpeg
Image

Dis tyn happen for 2009 wen man still dey look for admission for higher institution wey go collect me. I get dis friend 4 my house, him name na wale, I been dey tink say him be my best friend but I no say say wetyn him dey tink for me na evil.

He get one day, I wan wash my clothes outside and I dey listen to music for my phone, I come forget soap inside, I enter and 30 seconds no reach, I don come outside again but wetyn suprise me be say, I no gree see my phone 📱 again.

Na him I quickly call this my yeye friend say make we folo look for am, na him we look for 3 hours, we no see am. I no know say na dis my wicked friend carry am keep. Wetyn vex me pass be say, the next day, him folo me waka go buy anoda phone for Ikeja and him dey der wen I dey borrow 10k from my neighbor hand and him body no even do am anyhow or even pity me.

The God wey go catch am, the phone wey him steal na China phone, people dey call am "chinco" as d phone dey reign for Naija dat time and if you Sabi chinco well well, u go know say if u put alarm ⏰ inside the phone, even if d ba3 don die, d alarm go still sound.

Na wen me and dis my yeye friend go buy anoda phone for Ikeja na him the alarm for the phone dey ring continously. People for my house quickly run go him window go hear wetyn dey ring. Wen we come back, dem tell me say he be like say na my friend steal d phone but I no gree cus I just dey imagine how the person wey I call my friend go do dis kin tyn for me.

Dem ask am to open door, him no wan gree open but dem force am to, him come dey scatter hìn room wen the alarm sound again but still, na under him bed we see the phone, I no fit cry. Na from dat day I believe say some friends wicked pass enemies.

As I dey write dis mata now, Wale dey for street dey smoke Marijuana upandan. Him no get any plans for him life.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.17
JST 0.033
BTC 64258.81
ETH 2772.25
USDT 1.00
SBD 2.65