NAIJA PIDGIN CHALLENGE: ADDING THE BLOCK BUTTON TO THE STEEM SOCIAL NETWORK.

in #npc6 years ago

IMG_20180209_161502_243.jpgI don come again oh. This na naija pidgin challenge wey @ogoowinner don arrange for us.
For this one so, the tori wey dey on ground now na whether this our ogbonge steemit need block button.

My own talk inside this matter na say we need block button oh. I agree with @ogoowinner well well. We need am because bad belle people full everywhere. Some kain yeye people go dey write yeye comment ontop your post and e no get anything wey you go fit do about am. That kain thing no good at all.
At least if block button dey now you go fit block dem make dem no dey fit see your post again.
We even need delete button join sef so that we go fit dey delete all those yama yama comments dem.
That one na my own talk inside this matter oh.
Shout-out to @ogoowinner. You strong well well.

The picture wey I put so na picture of one better naija actor wey I dey sure say all of us sabi well well. E name na Pete Edochie.

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 64420.25
ETH 3150.23
USDT 1.00
SBD 3.99