Naija Pidgin Challenge part 3: The creed of life.

in #npc7 years ago

My beta beta people! How una dey? This na part 3 of the Naija Pidgin Challenge wey @ogoowinner arrange do for us so.
36NG-Chimamanda-Ngozi-Adichie-Featured-On-New-York-Times-As-A-New-Wave-African-Writer-With-An-International-Bent-01.jpg
So I don see the creed;this na my own interpretation,so make una read am.
All persons get right make people see,hear and love them everytime,na wetin I believe.
Every human dey equal,i believe am.
This world dey big enough to collect every people,na wetin i believe.
Everybody get am for 1 area of life,na wetin i believe.
I believe say every person dey unique and special.
I believe say everybody get am for angel and demon;so I go chase the demon comot,welcome the angel.
I believe say big big men ehn, na dem be the people wey dey do this race,religion and social status tin,make dem they control people,dey cause people to fight themselves and do this'i dey over your head' tin. So me, i dey tell myself I be human first before all these things dey dey bring palava.
I go do person how I wan make person do me.
I go do person how I wan make dem be,not as how dem dey.
I no go do wetin go harm another person.
I go understand people,i go try not to judge,but that one no go easy at all.
I no go allow envy,greed and jealousy do me strong tin.
I go do at least one thing for people before i comot this earth.
I go try dey kampe even when i dey cry and things don pain me well well.
I no go allow fear do me strong tin.
I no go allow mumu mumu things dey mind,i go comot dem fast fast,me I no say wetin dey the mind dey very powerful.
My dear,i go always do me;another person wey dey like me no dey.
I fit do anything wey I wan do if I put my mind.
I believe say life na journey not competition;so I go do my own tin,i no compete with any person.
I believe in peace
I believe in charity
I believe in forgiveness
I believe in love
I believe in mercy
I believe in justice for all
I believe in the human race.
I dey make the decision to live and not exist.
I Monago Irene will abide by this creed all the days of my life.
This na my own oh, @ogoowinner thank you for the opportunity.
My people,make we leave am here.

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 53699.14
ETH 2213.00
USDT 1.00
SBD 2.28