Naija Pidgin Challenge: Friendly enemies-Wetin my sister sister do me

in #npc7 years ago (edited)

My country people! This na part 2 of the Naija Pidgin Challenge wey this obonge girl @ogoowinner do for us so. Sister,i hail oh! You no say you too much!
Oya,make i gist you my tori...hope say this tori go make you shine your eye well well.
20180116_141920.jpg
Una dey see as i dey shine teeth so? Na so e dey do me for body that time. I meet this fine bobo,if you see as im fine ehn,you go no say fine people dey this world.
We dey for bus,na i see am;na i dey mope dey go. I come dey ask myself: which kain thing be this? I never see this type before oh! Next thing,im just turn look me,our eyes come jam! Omo if you see as i comot face ehn,me sef i no believe am oh! Im come waka towards me,come sit don near me. Then im start to dey talk; e say "hello,my name is George,what's yours?"
Surprised-Face-Funny-Black-Baby-Image.jpg
Na so e take start,i open my mouth dey talk,but me sef,i no say i dey talk nonsense. Na my sister from beginning beginning(that one oyibo people dey call bff)waka come. She bin dey buy lipstick at the park tey tey;so me i no fit wait for am,na i leave her waka comot.
Omo na she come dey answer the questions wey im dey ask me,i thank my God say i get better person.
boys_whatever____bff_forever_by_gisselle2405-d8yrfnt.jpg
Omo things just dey better from there oh! Im come ask my bestie for my phone number,she give am. Im say he go call me,then he waka comot. Na i jump ehn! If you see me that day,i no say i black,but that day,my face red oh!
winning-motivation-succeed-man-163496.jpeg
We waka go that 1st time,then plenty plenty other times. Everytime i see am,na so i go dey shine teeth up and down;Oyibo people say na "she's in love oh". Me sef i no wan know,i just dey happy.
express-glitter-top-5.png
Omo one day i dey gist my bestie wetin dey sup,na she talk say she wan go bathroom. I come dey look her phone based on who i be;her password long,but you no say i get am,so i put am open the phone.
My people,if you see wetin i see ehn,chai God! My heart wey dey jolly jolly before come fall for ground,i be wan die.
e60bd42bfe882661beb9eb95712cb497--sad-feelings.jpg
I see the chats with George,she bin send am naked pictures. Dem dey talk about how the thing sweet,how dem go waka go Lagos by end of the month. She dey ask am for money for plenty things,and im go tell her make she send her account number.
When she come out for bathroom,i querry her ehn,i no believe na my head dem two use drink garri like that. We come quarrel;she talk say na normal something,make i no dey vex. I be wan fight her,but i just leave my room for school waka go my papa house. I cry ehn. For evening,the bastard boy come call me tell me say im wan carry me go Kilimanjaro. Mtchew!
Na i shout for am,tell him make im no call me again. Then i block im number.
Since that day,i no dey too trust girls sharp sharp. This one happen 5 years ago,before i enter dokita school.
Na i say shine your eyes well well,this na my tori. I hope say una like am. Thank you!

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 53622.13
ETH 2208.05
USDT 1.00
SBD 2.29