NPC CHALLENGE 3 #my_ENTRY

in #npc6 years ago

As sister @ogoowinner take arrange dis anoda edition of awa Nigerian pidgeon contest, naim me ma say make I for take enter the contest so.abi how una see am.
For this edition na CREED OF LIFE be the koko, as e the hot

#IMG_20171225_083034[1].jpg

THE CREED OF LIFE

I believe say all of us suppose get ground for make dem see us, also make them hear us wen we wan yarn and make them love us too.

All of us na the same power and right we get because na one GOD create us so.

We suppose know say as this world big reach e go fit accommodate all of us wella.

I believe say everybody na baba for him lane oh

I know say all of us soji well well andwe dey represent ourself

I believe say all of us get that gra gra for body and we get that cool cool ginga for body but me I go pray to baba GOD make e for take comot the gra gra for my body because e no good like so.

I know say weda you black or yellow, you be Christian or muslim or you be ogboni, that one no concern me, the koko here be say na people wey no get better mind dey take all this one judge people.. na dsame all of us be. So make we accept ourself as human beings and we be one. Colour and religion no mata atall atall

I go the do people the way I go like am make other people dey do me..naso life suppose be. De talk am say make we love our neighbor like ourselves.

I no go dey yarn anyhow give people because say dem never arrive, I go the talk to them based on how me want make their life take better reach.

I no go do magu magu business wey go spoil anoda man chop.

I go the try my best make I dey understand people and how to take the reason their matter wella.

I no go ever allow bad thinking and oju kokoro enter wetin I dey do for this life.

I go make sure say I go do better thing wey people go enjoy well well make their life go better before I go comot from this world.

Weda contition bad or good I go still stay strong and pray make baba god helep me so because one day e go better, na poor man prayer be that.

I go stand gidigba, no shaking, liver no go ever cut me.

I no go allow bad thinking enta my head, I go change am with prayer and beter thinking any time wey the bad thinking wan show. Na good thinking naim sure pass.

I go always be myself, because after me na still me, no body reach.

I go always the do my best for any work wey I dey do so that better result go show.

This life wey we dey na jeje so make we no the hurry because dem no dey give price for first position for this life wey we dey live.me I go dey my lane je je.

I believe in peace

I believe in charity

E go make snse wen we forgive ourselves

Make we show love

Make we dey temper justice with mercy

I believe in justice for all

I believe in human race

I don decide say me I go “live” life no be to just “exist” be am

I ABDULLAHI HASSAN with steemit name @hassanics don decide say I go abide and follow this creed all the days of my life (amen)

Make we no forget to pray for our NIGERIA, one day e go better.
Make we dey hep each other , no matter how small the help be, e go still make sense.

Make we no the fight ourselves, GOD no like that kind tin.

As election don the near so make we no forget to go do our voters card oo,we don suffer too much na our vote go count this time oh, our votrs card naim be our WEAPON. MAKE UNA VOTE WISELY.

GOD BLESS US ALL
THANKS FOR READING.

Wole-Soyinka-speaker-2.jpg

STILL ON THE NIGERIAN PIDGIN CHALLENGE. this picture na for this site i take am from image source

thanks to @ogoowinner

.
proudly genesisproject
proudly stach
proudly goldenproject

ONE NIGERIA

Sort:  

This one Na correct.
Well done.

thank you @gee1 na ur footstep we d follow

Woke soyinka

I grate am
I can't say he is my role model but I look up to him

You do well

Na bible talk am say make we love our neighbor as we come love oursef. U dey correct. Na correct post b dis one

Correct. Done and dusted

Good post
Thanks for sharing it

Sure religion and colour no matter at all, make embrace ourselves and uphold to one Nigeria. Naija go still better. Chai I hope say my pigin good like @hassanics own. Come teach me boss

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 58802.33
ETH 3158.99
USDT 1.00
SBD 2.42