NAIJA PIDGIN CHALLENGE: FRIENDLY ENEMIES

in #npc7 years ago

My people, I greet una. This one na part 2 of naija pidgin challenge wey @ogoowinner don arrange for us.

As e dey be eh, no b all friends be friends oo... One time like dat My fada get one new work way dey far from where we dey stay, so him com say make we pack go a new place... No wahala na. We carry everything go there, then e com realise say I no go fit day go school from that place cos e day too far. Him n my mother com decide to change my school... D tin vex me eh, but watin I wan do, I gree na.
So d next Monday my fada com drive me go d new secondary school... D place make sense she😎, but I still day miss my old friends😐... I just make up my mind say with time I go adjust.

After like 2 days I con start to make new friends. I meet one gal like dat (Peace). This girl fine die👧... U know d levels na, all d guys day on her matter. Me and this girl com dey very close.Screenshot_20180126-113637_1516963394726.jpg

She dey come our house, everybody know her. D only problem I get with her be say she sabi Waka... Other than that d babe na my tight padi... We dey run things together👯... We dey go school together, come back together... In fact some people com dey call us twins👭
Sometimes this babe fit come our house sleep till d next day, me I dey do d same for their house too... Our closeness even bring my parents n her own parents close.
Screenshot_20180126-113629_1516963428701.jpg

One dey Peace call me say whether I fit escort her go get something for her mother, I say no problem. I tell my parents them allow me go. I reach her side then we commot together... We reach one bar like dat, where she say she wan collect something for her mother so I just say make I wait outside make she collect d thing sharp sharp make we dey go... Ah ah before I know watin dey happen, babe don spend like 30 minutes inside d place. I com dey wonder abi person dey hold her inside there... I com say make I enter go check. As I enter I see her sitdon on top one guy leg, HA!!! Watin be this... I no know where to even start from. So I Waka go close to her com tell her small small for ear say time don go, so that we go dey go house. She com stand up, tell d guy bye bye, then we commot from d place.

As we dey go she com tell me say e get one back road way we go follow go reach her house quick quick... Na her area na, she sabi d place pass me, I gree. We com dey pass d road when 3 guys just show up from nowhere... Come see fear 😱 where I wan run go na. Bt I notice say Peace been day smile with them..
The next thing I see d guys don dey remove their belt. D only thing way commot from my mouth na"Jesus Christ, I don die today". So one of d guys com wipe me with d belt(God! I nearly crase). U wan see cry, I com dey shout, dey beg...
Then luckily for me one military man just dey pass, as d guys them sight am they run commot including Peace... The guy com carry me go house. As we reach my parents don vex scatter. I tell them say peace dey involved then they call d police com arrest Peace. For d station there, Peace com they tell them say she do everything out of jealousy... Say na she be d finest babe in class till I come... Say most guys no dey give her attention again. Say she been teach me a very good lesson...
Me I been no believe watin I dey hear because not even once way she behave like say she dey jealous...
But thank God I don learn my lessons, I go dey careful next time.
Abeg make I salute @ogoowinner for this ogbonge opportunity to share my tori.
I hope say una go enjoy am.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58058.49
ETH 2284.09
USDT 1.00
SBD 2.51