Friendly Enemy - True life story

in #npc7 years ago

To all my followers especially to non-nigerians, I apologize you may not understand the language I am about to use in telling this short story. It is our pidgin English here in Nigeria as required by @ogoowinner's naija pidgin challenge. The theme is friendly enemies. If you are interested in the story but can't understand it, ask me in the comment I may summarize it for you.

Henhen, this tori wey I wan share with una na one matter wey make me vow shey I no go ever trust any man till I die

The thing happen when i dey university, we be four group of guys wey dey waka together and we dey stay for the same hostel. Na the same street for Ibadan me and one of the boys wey hin name be Posi come from. E mean say we close well well, hin parent sabi me wella and my own papa sef sabi am. We parents dey always send us to each other if any of us go house.

As me and this boys dey play and waka together, things dey always loss for our midst. Since we be paddy, we dey reason am say na one pesin from outside dey come thief our things.
E get one day, one of the boys Yomi dull hin phone for outside. Me come see the phone, pick am. Onto say paddy level, I no give am the phone immediately. After few minutes I give am the phone and that one pass.

E get one day i wan travel go house, as I pick my bag say make i commot na hin Yomi block my way say I no dey go anywhere. He talk say hin dey look for his PSP and dem dey suspect me because of that day wey i use phone follow am play. Naso my body hot say which kain nonsense be this, the boy search my bag he no see anything. Still hin dey insist say na me carry hin PSP. Other boys include Posi wey we come from the same street come dey use style style support am. Naso my hand fall anyhow. Me and Yomi sha fight wey be say everybody for hostel know wetin dey sup. Hin come be like say make ground open mouth swallow me. On top something wey I no do.

I sha travel the next day. Na house I dey wey one person call me say dem catch Posi (the boy from my street o) for inside campus sey hin thief phone. Hin steal one phone and the owner come see am for the hand of the pesin he sell am give. Naso him yawa gas. Na after dem arrest am and hin buyers with police call hin parent, the boy and hin accomplices come dey confess different phones, pesin school fees and many properties wey he don thief even the PSP wey dey accuse me on top. Chai!, and na this boy I dey call my personal pesin.

Credit
This tori with others wey don happen to me and the one wey I don use my eyes see don teach me better life lesson. No matter as me and pesin close reach, I no dey ever trust anyone totally because human go everly be human. Dem dey fuck up or fit fuck anytime.

Abeg if u enjoy my personal experience wey u read or even you no enjoy am. Hammer me better upvote. I be your boy o.

Sort:  

Hmm
Pele
But that one no mean say you no go trust person again nau
People get different things for heart
No day use one person judge everybody

Your story day alright

You dey on point bro.

I just dey try protect myself or my heart because I don see many things.

U know as dem talk that talk "better safe than sorry".

I thank say u take time read the tori and for the advise too

I was dealing with a guy from the US sometimes last year and at a point he sent me money to deliver a good, we've not seen before, we've not met before. I delivered the good to him in lagos and asked him, how come he trust me that much and he responded by saying if you must do anything in Nigeria or in any business, trust is a risk you must take, it is absurd but u have to. So you must trust again

I do business transactions online a lot with total strangers. I just did one few hours ago with a guy I properly will not lay my eyes on. I take those trust risk every time but letting someone into my life or heart is a different ball game.

Thank you for the advise @royalheir

Lol. 😂. Take this better hammer 🔨; I even give you double-decker join! ⚒

Lol... Oya use the hammer hit me with better upvote

I wish! Soon, brother!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58665.29
ETH 2302.95
USDT 1.00
SBD 2.51