Wetin Friendly Enemies Don Do Us - Naija Pidgin Challenge

in #npc7 years ago (edited)


Source
My people for steemit, I dey hail una well well oh.
Wetin carry me come here write dis tori wey una dey read so na wetin @ogoowinner talk for her blog this morning o.
She come talk about wetin friendly enemy don before for this life, na im me sef come say I wan talk me own. My country people, even una sef fit talk una own tori about this matter o. Make una just remember to use the #npc and #nigeria tag.

My country people, my own na about one time wey I enter villa like this o. I carry my leg jejely go there to jolly with my people for Christmas o.
I no know say e get some people wey carry us for mind. Dis people na guys dem wey we dey gist with for afternoon o, we no know sey dem carry their own plan for mind.

As night come reach na im dem come wan rob us for house. Na just God wey help us as e come be say some people for d house never sleep. Na so so shout we just dey hear "thief, thief", we come catch them come discover say na our guys o. Thank God say nothing happen and their plan dem e no come succeed.

Sort:  

Congratulations @gamsam! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes
You published a post every day of the week

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58665.29
ETH 2302.95
USDT 1.00
SBD 2.51