The Creed Of Life. (NPC Episode #3). @ogoowinner NPC contest.

in #npc7 years ago

I lay down flat for you @ogoowinner for this pidgin challenge you nack ontop steemit.
my belif be say na everybody get chance to see, to ear and also get opportunity to love person.
I belif say na the same we all be.

I belif say this world wey we dey so get enough space wey we fit stay.
I belif say na everybody Baba God carry talent give.

I belif say na everybody better and dey special.
I belif say we all carry bad things for mind and also get better thing. But me go try kill the bad things wey dey my mind and carry better thing wey dey there out.

I belif say run, relion and all this social media dem matter na to cause confusion among us, na wetin dey cause gbege between us be that but i con deside say i go be myself first before i begin dey copy another person.
I go treat people as i want make dem treat me.

I no go show am for face if person good or bad, because na good i want for everybody.
I no go put hand in any bad thing wey fit cause gbege for another person.
I no go judge people because i know say finger self no dey equal.

I no go let envy, jelousy and greediness allow me misbehave.
I go make sure say i do wetin go make me porpular for this world before Baba God call me.
I no go let bad things of this world weak me.
I no go let fear take me as tight friend.

I no go allow bad thing for my mind, i go carry better thing like peace take replace am sharply because i know say, na wetin dey person mind get power.

Na my original self i go dey be always, i no go copy anybody.
I belif say i fit change this world if i work hard.
I know say this life na like head, we all get our own, i no fit replace my head with my friend own, so i no go copy anybody.
I no belif in fight, na jeje i dey go.

I belif say make i dey share little wey i get with people wey no get atall.
I no dey carry person for mind.
I dey carry love dash everybody wey dey arround me.

I go dey carry help give people wey no get helper.
I belif say na better thing if i judge matter as the matter be.
I belif say na only me fit change the world.
I don decide say i go live for this world but not to live only but to change things.

I Awowale Kolawole go dey carry this creed waka as i dey go out, till i peme... Make Baba God help me.

credit

The picture wey u dey see so na our ogbonge naija artist (Innocent Ujah Idibia).

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 64409.17
ETH 2631.52
USDT 1.00
SBD 2.79