@OGOOWINNER; NAIJA PIGIN CHALLENGE; Wetin friendly enemy don do me

in #npc7 years ago (edited)

Good day my country people. Hmmmmm this matter wey sister @ogoowinner carry come this week end no be smalll thing ooo.
I no fit forget wetin friendly enemy do me in the middle of last year, water still dey drop for my eye as i remember this matter.

credit

I get one childhood friend wey be my age mate, this guy na my tight friend, na guy wey be say ehm no fit sleep without seeing me. This guy i dey talking about fit sacrifice his life untop say someone else wan survive, as we begin dey grow together we dey follow go church for prayer self, make i cut the story shot. Me and this my guy follow play visa lottery but fortunately for him dem give am visa, the guy come travel go obodoyinbo, but then talk say the guy must marry before ehm go travel make i no long story sha, this guy travel. But make i no lie una, the guy try for me die, wetin cause our seperation be say, ehm wife for naija here get another guy wey she dey friend but the lady dey always tell me say the guy na her brother, as the matter no concern and the lady na my close friend, i just count am as nothing, e get one day wey i catch both of them for inside room dey romance, the lady just begin dey beg me say make i no let her husband wey be my friend know but as the matter be, i just carry am put for body.
This lady no believe say i no tell my friend, next thing i see be say my friend just block my contact, since then we no follow yan again.
Na my friend younger brother come yan me say the lady don go cast me for my friend na wetin make my friend block me be that.
Na only Baba God fit help us from friendly enemy.

You get mouth die @ogoowinner

Sort:  

I feel your story oo...
wonder shall never end.

deris God!!!!

Lol.... Thank you for your comment

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58239.61
ETH 2287.71
USDT 1.00
SBD 2.50