Naija Pidgin Challenge ●••● Why I Like Steemit....Contest By @ogoowinner

in #npc7 years ago

Good day to you my country people. hope una shapa shopo well?
As @ogoowinner talk say make we yan wetin make us like steemit, na ehn make me wan chook mouth as una know say we no dey carry last for naija here.

IMG_20180117_161246_1CS[1].jpg

I no fit forget @bekky wey carry me come this steemit platform.
Wetin con make me like steemit be say, steemit don make my life better as my family don turn me to their small god.
Make i quickly yan you one tori.
Na elect elect i study for school but as matter be for naija, na one small company for Lagos just employ me as driver, as i no get choice i just say make i dey manage the work before @bekky come carry steemit matter nack for my domot.
I no go lie una, my life don change since then.... i just tell my oga say i no dey do driving work again and since then, i no regret say i quite my work for steemit.
Make i no lie to una, steemit dey sweet me like Apu and banga soup.
Make i sharply use this opportunity hail my oga dem for steemit.
@ehiboss, this oga ehn e get mouth die for @genesisproject group, i no go forget my steemit daddy @dreamchasser, my steemit mentor @princeola i comot cap for una ooo.
Steemit don make my life kulele.
@ogoowinner na only baba God fit reward you for all the better thing wey you dey carry come steemit.

Sort:  

The @OriginalWorks bot has determined this post by @fr3world to be original material and upvoted it!

ezgif.com-resize.gif

To call @OriginalWorks, simply reply to any post with @originalworks or !originalworks in your message!

Please note that this is a BETA version. Feel free to leave a reply if you feel this is an error to help improve accuracy.

This post received a free Upvote. Get your free Upvote NOW! Just follow @upvoteforfree

Na wa for this ya pidgin o... I cut cap for you as u be ma oga now

Na as steemit be for you na so e be for me too...

No yawah for any body wey dey steemit o my bro...
@bekky

Lolz, na so my sister... steemit dey sweet me pass obodoyinbo.

Naaa soooo!

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 61651.16
ETH 2369.36
USDT 1.00
SBD 2.50