NAIJA PIDGIN CHALLENGE: FRIENDLY ENEMIES NO GO KILL PERSON

in #npc7 years ago (edited)

ibom%2Bstadium%2B1.jpg
This is an aerial view of the Akwa ibom stadium. It is world class and is called den of champions

This fake friends and friendly enemies no go kill me. Make una hear the tori I carry come. E get one of my friends dat dat year wae do do like say he be my guy. E name na franklin. The boy na my classmate from primary 2 for school. Me and this guy don tay no be today. My papa sef don sabi e papa because of how we dae close. Even sef the boy dae sleep for my house. We dae trek they come back from schoo together but where I fear am na one day when I bet money win am. I been happy dae tell my man franklin say I Don chop money for bet show am the slip. Before I go collect the money for morning I no see my slip again. I find am tire I no see am. I come dae cry dae go the shop them tell me say them no fit help me.IMG-20180123-WA0008.jpg I complain give franklin tire him just dae console me. Na until three weeks later when my man buy big phone I come e house go see the phone I come see the alert from the betting shop say na him collect the money for his phone as bank alert IMG-20180123-WA0011.jpg
Chai, I no fit shout. I Franklin don kill me. I no even hala am. I ask am he deny I come go the shop them come show me the slip exactly my slip. Fake friends for this life no go kill person @ogoowinner sef confam am.

Sort:  

This post has received gratitude of 0.93 % from @appreciator thanks to: @fminvincible.

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 68643.84
ETH 3277.52
USDT 1.00
SBD 2.67