NAIJA PIDGIN CHALLENGE Episode 3 : The creed of life

in #npc6 years ago

IMG_20150409_125217_2.jpg

The image above is ikogossy warm spring in ekiti state, nigeria. One of the few warm springs in the world is accytually in Nigeria.

Translating this creed was really difficult but I really hope this is good enough. Thanks to ogoowinner for the platform.

I feel we still suppose show all man the leanest love and we suppose hear all man voice for the mata

I feel say all man na one. Man no big pass man

I reason say space dae for all man for the zones
I reason say monkey no be swimmer, fish no be climber. Man suppose get wetin e sabi.

All man get e own. No two man na one. Aboy and bobby no be the same.
E be say everybody na devil, still be angel. Make my devil calm down make angel show e sef.

All them tribe, church with money no be anything. Na division wae e dae cause con dae make some man raise shoulder for some man. All man na man. Me sef na man before anything.

I go do pesin wetin I wan make e do me
I ni go rush dae vex 4 people Way vex me. I go reason them based on how I want make them be

I no go put head for wetin fit cause kasala for brother.
I go try get people well well, I no go judge them
I no gree jealousy, and hate hate with long throat dae control me.
I go try achieve something for this life before man kpai

I go try hold myself no cry if kasala burst for my head.

I no dae far anything for this life

I no go dae think bad things for mind. I go sharp sharp dae think beta beta things because na wetin man think e dae do

I no go do copy cat. I be man for my own

On how I use muscle follow matter I go make difference
This life na per head but no be gree die. Me and person no dae do race.

I be man of peace
I be man of give give
I no dae carry person for mind
I be man of love
I no dae wicked I dae pity people
All man suppose get justice
All man na my brother man. I dae reason all of us.
I wan make my hands clap for this life. I no go just exist.
I ROTIFA OLUWAFEMI go dae faithful to this decree till I die
I Rotifa Oluwafemi will abide by this creed all the days of my life.

Thanks to ogoowinner for the opportunity.

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.029
BTC 60808.77
ETH 3368.54
USDT 1.00
SBD 2.47