Making the Steem social network better by @ogoowinner, NPC

in #npc6 years ago (edited)

images(58).jpg
Source
Una Good morning ooo, e don try wey I do dis ogbonge thing. Twale to mama @ogoowinner, mama give me the chance to yarn wetin I want make Dem add for Steemit

The one wey carry Belle na the delete. Kia, e dey important, as a JJC some of my post upvote no even smell am not to talk say money even enter, it dey kill moral. When I dey see am I dey weak. If say delete dey I for don delete am since

Make Steemit do voice and video call room, me like video call die. Make I dey see the other person like my mama @ogoowinner. I wan dey see her fine fine face, I always dey hear say Igbo girls dey fine when I see you I believe, mama you too fine

Notification dey important I don tire to dey call people say I mention Dem for my post, my school mother @tutufaith wey introduce me to Steemit done tire to dey hear say I mention her name. At least I no suppose tell them say I mention them. Dey gas see am nau.

The last one no be addition and just suggestion, abeg if dey fit help us reduce this percentage for new comers like me.

Na my own fin wey I want make Steemit add so e go helip my life. So o go dey poff up and down.
Mama, double twale inshort three gbosa for you, you to gbaski, your head dey there

The photo wey dey my post na one ogbonge musician. Mama of all Mama's for music. Onyeka Owenu

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 65834.37
ETH 3292.65
USDT 1.00
SBD 2.70