The Creed of Life-NPC Episode 3

in #npc6 years ago

I believe everyone has the right to be seen, heard and loved.

'I believe am say every person get right for people to see am, hear am when him want talk and even make people like am well well' .

I believe all humans are equal.
'I believe say every body way de breath na de same level we dey'

I believe the world is big enough to accommodate everyone.
'I believe am say this world like this big welas to carry all of us'.

I believe everyone is a genius in at least one area of life.
'I believe am say every person sabi something welas for this life'

I believe everyone is special and unique.
'I believe am say every person get him own value for people eye and dem dey different from everybody'

I believe everyone has a beast and an angel inside of them. So I will try my best to tame the beast and arouse the angel.
'I believe am say every person get him own wowo and fine way wey them de behave. I go just do make I catch him wowo side hide am den wake him fine side'

I believe race, religion and social status are nothing but the creation of contentious men in order to control others, cause strife and in-plant the supremacy mentality. So I choose to be "human first" before I am of any race, religion or class.

'I believe say where we come from,the way we de serve our God and who we be no be any tin at all. Na God just make us make we de control everything way him create. I go try be better person first before I go de consider where person come from, how him de take worship God or de level him dey'

I will treat people as I will like to have them treat me.
'I go dey do or rapor with people dey way I want make dem sef do me'

I will not react to people based on who they are, but who I will want them to become.
'I no go dey follow person yarn because of who him be but because of who I want make him be'

I will partake in no business or project that will cause harm to another person.
'I no go dey do something way go de cause kasala for another person'

I will strive to understand people and not judge them.
'I go try to de hear people talk and to reason am well. I no go dey carry bad mouth condemn dem'

I will not allow envy, jealousy and greed to control my motives.
'I no go dey reason yeye matter, bad belle and to wan chop plenty make e de control wetin dey for my mind'

I will accomplish at least one notable thing for humanity before I leave this earth.
'I go make sure say I do something way go make people hear my name before I comot from this world'

I will try my best to remain strong in the face of misfortune, grieves and sorrows.
'I go try make I stand gidigba for where bad luck, bad mind and bad things way go make person de cry dey'

I will not allow fear to intimidate me.
'I no go gree make fear push push me comot road'

I will not allow any negative thought to occupy my mind; I will replace them immediately with peaceful and creative thoughts as soon as they come up because I know "thoughts are powerful".

'I no go gree make bad thing collect house for my mind. I go just replace am with tin way de cool and tin way go make me do something big as they just come my mind. I no say to put something for mind get plenty power'

I will always be me, my original self and no photocopy of another.
'I go try make I be who I be, the way God make me and no be to go de do copy copy'

I believe I can make a difference if I put in my best to any given task.
'I believe am say if I bend down put mind for something I go do one dey way where no body don do before'

I believe life is a journey and not a race, so I will not permit myself to go into competition with anybody.
'This life na joni oo, no be who run pass oo. So I no go just gree make I dey follow person de drag who big pass'

I believe in peace.
'I believe am say make everything de cool.. Make yawa no de'

I believe in charity.
'I believe say make person dey open hand help people way need help'

I belive in forgiveness.
'I believe say make we no de forgive person way offend us'
I believe in love.
'I believe say make we de like each other well well'

I believe in mercy.
'I believe say make we the pity people way need help'

I believe in justice for all.
'I belive say make we the do the same thing to everybody'

I make the decision to "live" and not merely
"exist".
'I con gree for my mind say I no come dis world to just sit down for one place, I go do things way go make people remember me'

I............(your name) will abide by this creed all the days of my life.
'Me, Gideon @excel6068 gree say I go follow all de talk way I yarn for this place as I dey this world' .
Make u try do your own o
@ogoowinner, I twale for u oo. Na u try pass

IMG_20180129_223002_310.jpg
I like babies eh. Dis one na fb I see am. She too fine Joor..

Sort:  

Nice post... A beautiful Child

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 61240.20
ETH 3247.86
USDT 1.00
SBD 2.45