Na my own creed of life be this

in #npc7 years ago

Make i first of all thank you @ ogoowinners for all the good good things wer u Don de do for your country people

I de convince say mankind get right make dey see am, yarn and love

I de convince say man pikin dey same level.

I go try to dy have impact for people life and dy yarn dem say make dem dy do same for others as this go help improve our ogbonge life

I believe say make we dy witch another man pikin no good, this world go be a better place if na to say we dy help ourselves

I believe say no matter the kind better things wy you dy do for life, bad belle people go still dy witch you.

go use all my power to understand people and not judge dia matter just like that.

I no go let envy, jealousy and greed control d tins wey i wan achieve.

I go achieve the leanest one tin wey go help my fellow man before I kpai.

I go use all my power, try stay gidiba when things no dey go well for me.

I no go allow fear shuk me for ground.

I dey always put for mind say nothing for this earth dey impossible.

I believe say no body too small so I dey make sure say I treat everybody well

I no dey lie for the place wey I suppose talk true

I believe say to love na better thing

i believe say to show mercy make better sense

I believe say we human beings make sense

I @emma go must do this things wer i talk so help me God image

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 62149.46
ETH 2438.84
USDT 1.00
SBD 2.68