WETIN UN-FRIENDLY FRIEND DO ME. !

in #npc7 years ago (edited)

source

THIS IS MY ENTRY FOR NAIJA PIDGIN CHALLENGE BY @ogoowinner

No be small tory I wan yarn Una so. E beta say person get enemy korokoro than say person go get the kind friend wen go dagger am for back. 

My own be say make I no discover o, na cutlass I go carry, I no lie you. 

This tory happen four years ago, I get one very close paddy, im name na Samson. We start our friendship from JSS1 and we dey do so many things together, even wear each other cloth but me I no know say im get bad mind for where I dey. I take am as my personal person but im come f**k up. 

We come dey hustle for admission but I no know say im get powerful contact, e no even by mistake mention am. The one wen pain me pass sef be say I use my bike dey carry am up and down. Mr Emefiele na the man wen we know but I no know say e fit help person run admission stuff. One day, Samson say make I carry am go the man house, say im papa send am message. As we reach there na, e say make I stay outside. I come stay outside come dey play with the man dog. I no know wetin dey happen inside. As im come out, we come even go my house go wack better food, Indomie and egg wen i use my own money prepare. 

Wen list come out na, my friend get admission, me I no get. But if you see as I dey jump up like frog, you go think say na me get admission. 

Na im papa even let the cat out of the bag. As I no get admission, Samson papa come surprise because I score pass im son. Na im come tell me say na Emefiele na im help dem. Samson papa come call am, dey quarrel with am say why im no tell me. Samson no see mouth talk. Im papa come give me note sharp sharp to go meet Emefiele but e don too late. Im come promise me the next year. But the man come die 8 months later from one kin sickness like that. 

Today ,im dey two years ahead of me for school but e no matter. E no dey fit look me for face but me I dey ignore am like say na ant im be. 

The thing too pain me sotay I no come get friend again, I mean close friend but God dey. If na so friend dey be, wetin you wan use enemy do ? Make Una answer na 


Special thanks to @ogoowinner for putting this together. I had fun writing this because I had never written in pidgin English before. 

Sort:  

Congratulations @eleaza! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of comments

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58239.61
ETH 2287.71
USDT 1.00
SBD 2.50