NPC episode 3- The creed of life

in #npc7 years ago

IMG_20180130_170549_185.JPG
*naija picture
source: my gallery
Ds life no get part 2, no b naija film. If you die, u don die. Live am like say na im be ur last.
Anoda ogbonge challenge by @ogoowinner don show for our table be that.
My people of naija! Na my creed be this
Evry body get right. No mata who im be, mke person notice am, mke person hear am, mke person die for am
Nobody big pass na im i believe. Everybodi dy dsame level no matter who you be
This world we dy so fit contain all even if say u fat die or ur head big die, ds world go still reach you
We get one area where na we be oga kpata kpata for dt side
I believe say nobody dy dsame for ds life, even ejima wey get dsame face no get dsame ability
I believe say winsh dy, angel dy. All get two of dem but i go do well pepper dt winsh side.. Pepper dem gang oh baby
Person skin, oyibo or blackie, person church, person yagi levels.. Finally nothing dy any of them. Na just some kind oga wey put dem der wey come dy mke some peopl reason like say na dem big pass
As I wan mke u do me, I do you. Man no go vex
I no go reason ur mata based on who you be but based on who awon make you be
I no go put hand for inside awoof business, business wy no pure, wy go pepper oda people bodi. Pepper dem gang no follow for ds one
I go make mark ontop sand before i kick boket
Evn wen my villagers dy win, I go dy gidigbam dy sip my palmi becos in d end. Na godwin
Odeshi o. Fear no go shake me
Na only beta tin na im I go dy reason. Wicked thoughts no go follow me all the days of my life
Na me be the koko, no tear rubber, I no be aba product
I fit mke change, no b dt kin Apc or buhari change sha

I be nigerian, i no b russian. Ds life na jeje, no rushing, no competition. Person wey finish first na die be dt na. No b say I go dy dull for one corner o#onecorner #onecorner
I believe say ds kin tins dy
Peace dy(na im be my middle name sef-udochi)
To dy give person dey
To no carry mind for person wy chook u dey
To show mercy dey
I don talk my own say I go live, I go laff, I go learn.
I, Amaechi Daisy Udochi go keep to this creed sotee I die!

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 59702.71
ETH 2542.73
USDT 1.00
SBD 2.54