MY NPC ENTRY WITH @ogoowinner .....THE CREED OF LIFEsteemCreated with Sketch.

in #npc7 years ago (edited)

This na my own translation for the CREED OF LIFE wey our sister @ogoowinner don arrange for us.
29-3.jpg

Na so my tori go,
● I believe say them suppose dey see wetin everybody get to show, hear wetin everybody wan yarn and dey loveerize everybody
●I believe say all human being them na the same, nobody big pass the other person....everybody na mate
●this world too extra large for everybody to dey inside na so I believe
● I believe say everybody sabi something for this life wey we dey so even if na only one thing him sabi do
● wetin I believe na say God done bless everybody with their own gift wey make everybody to come be oga for their own area
● see ehn, , everybody get their own devil wey dey worry them for Inside their head, I mean scoi scoi!! As them take get devil, na so them take get angel too wey dey inside.so the thing wey I go just try do na say I NO GO COME CARRY MY REGGAE DISTURB THEIR BLUES, that is I go dey pour that devil Holy water and dey do everything wey go make that angel inside dem dey show like t.v.
● I know say nothing concern where you from , wetin you dey serve and all the things wey you try get for life with how you for take dey behave inside where you dey because all those things na just wetin man carry him hand do so that him go fit dey use people head, dey cause kata kata and dey burst the speaker wey dey some people head come dey make other people feel like say them no reach. But me wetin I don choose na say I no go allow all those things dey make me treat people lik say them carry shit for yansh!
● I go dey do people the I want them to do me.... issa do me I do you something
● I no go come dey para on top wetin person be , Instead I go chilax and dey carry them along because I go for like make them better for future
● I no go involve for any Yama Yama business wey go wound another person
● I go sha as try to understand people , no be to con dey do Jesus Christ work dey judge them
●I no go con say "ewo because this person get pass me today come dey on a chuking eye levels dey allow that one cause problem for me and my brother or sister
●I go do, even if na say na one kinkili better thing make people see say e good for eye for this life before I mud
●I go try everything just to dey obonge even when wahala o, yama yama or yakata show
●Fear!!! Them never born you finish sef to come dey enter my body, I no go allow that kind thing happen
● I no go use this mind wey bros J give me come dey think bad bad things because bible talk say as man dey think na so him be! Instead I go pack better things wey dey give md joy and things wey go open my head take full inside my mind because I know say wetin dey ring inside person head get power to make the person jonze or do better
●As I dey na so I go dey... issa see finish something, no duplication for my side
●I know say 3 and 4 na 1 be the difference. Na that kind better difference wey I wan be , carry all the akpobi and liver wey I get put inside anything wey I dey do
● this life we dey e just be ike say na travel we come so no be ON YOUR MASK. As Na wetin I believe I no go come dey do competition withh another person
● I believe say make we get peace for world so person go fit drink water drop cup and sleep with him two eyes close
●Even the bible talk am say person wey dey give no day lack, so make we no dey do stingyko
●Forgive one another, no carry bad belle for another person as e dey for inside bible say forgiveness na everything
● I believe say make we dey show love as as them tori us for inside bible say make we dey love our neighbours as we take love ourself
●Make we show mercy as nobody take perfect for this life
●I believe say make we dey talk truth no matter who you be
● I believe this human race die!
●I don agree by myself say I go live this life no be to just dey look uche face

I CHUKUIBI JENNY don agree by myself and with myself say I go dey practice all these things wey I do yarn so for here until the day wey I go close eye..
So Baba God make you take help me!!!!!

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.13
JST 0.027
BTC 61328.01
ETH 2752.11
USDT 1.00
SBD 2.45