My people make una help me thank God, steemit don do am again oh!

in #npc6 years ago

wetin steemit don do for me, na for pidgin e dey always sweet me to write am pass o and i been dey think say na for only @surpassinggoogle #untalented contest i fit write am, but @ogoowinner don give me opportunity to, enjoy my self aunty ogoo you do well o, abeg no be everytime person go dey yarn big big grammer, abegie even oyibo sef no fit speak our own, I know say If them dey read this my post e go be like chineese for thier face, naso e suppose be we use this one pass them.

Make we enta the tori for today as my write for my topic say make una help me thank God steemit don do am.

wetin steemit do

  • He collect me for faucet hand
  • He collect me for Facebook hand
  • He collect He collect my selfie and slay queen talent for my hand.

Before before na so so faucet I go dey enter they find site wey I fit claim free cryptocurrency but since wey I join steemit I don learn plenty things for this cryto matter for #genesisproject and for ogoowinners forum wey @ogoowinner open to discuss crypto matter for cryto noobs like me to fit learn.

to cut the long tori short steemit don help me dey get value for all my time wey I don waste online and for social media, steemit help me shut those people wey be say every time dem go dey tell me say, Funke you too press phone Funke you too snap picture some go even tell me say The day wey this your phone go spoil you go sick o

all this talk no be lie o na true talk, them talk, even though all this talk never change but now, when them dey talk I fit proudly shut them up when I show them all the better better things wey I dey do on top steemit and all the things I don achieve for steemit .

even my elder brother, naso him go dey talk, when I complain to am say my data dey finish quick, that time wey I just enter steemit make e subscribe for me e nor go gree e go tell me say I nor get better thing to take am do say na mmm ponzi me I dey do online say him no wan hear say them carry my money go o, but me I get luck for that side sha any ponzi wey I wan join they day wey I wan register na that day e dey crash, una wey ultimate cycler and mmm agents chop their money make una nor vex, God don send steemit to come to restore all una loss. back to my brother matter since the day wey him join steemit e nor look back again o him na one of the ogbonge game reviewers for steemit now na @itwithsm be him name.

For steemit I don get friends, I don get mentors, chai

make I end my tori for here cus if I begin open book we nor go comot for here today. I thank una.

Sort:  

Congratulations @cassey001! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of posts published

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.14
JST 0.029
BTC 57174.31
ETH 3071.24
USDT 1.00
SBD 2.40