Why me too like steemit

in #npc6 years ago (edited)

Make I first greet una way dey read my post so, my name Na emmanson but una fit call me biggi, I be correct akwa Ibom boy with correct akwa Ibom accent.

IMG_20180113_143719-01.jpeg
Na me be this(i hope say una Don see why Dem dey call me biggi)

Before me come join steemit, life been no easy ohhh. Since my mama and Papa Don retire for work force(unto say I be boy I got hustle) e bin no dey easy for me. The phone I been the use for three years Na selotape I take the hold am together.

IMG-20180103-WA0006.jpg
see dey old phone here

IMG-20180103-WA0009.jpg
check out the new one

E get time way e reach so tah I come start to dey play bet9ja (as a true 9ja boi sha), my dear e no easy you go play game one cut(e dey pain for chest). If bet9ja no pay me, me no fit put credit for phone, me no fit pay tfare comot.

Finally my mean gee @ungest come dey yan me and one of my guy @enajo about steemit. Me and my guy come the laugh am say Na better scam, my guy say no be scam him show me alert him sister collect, I shock!!

Me way no get sub for phone, I come the think How I go take sub my phone start this stuff, my guy come show me love, tell me say when E pay I return. Me self the fear ohhh (what if this thing Na scam, where I go take 1k return).

I come finally start up everything, after I Don wait tire, Dem come send me my confirmation(i for happy die).

Make I Kukuma cut dey Tori short, e no reach 2weeks after I join steemit, I buy new phone, return 1k Give my guy I even add small sometin on top. I come even shun bet9ja so tah area come the ask me to show Dem dey way. Na it I come bring Dem show the way @aniekanbassey, @emmanue782, @joeysyrup, Dem still plenty make I no come tire una for small Tori.

In fact self make God bless person wey do dis steemit. Steemit e don touch and change plenty lives for 9ja and for dey world.

Make I follow take this chance to thank Our big anty @ogoowinner where follow join hand give me chance to tell una why me like steemit.

Unto 9ja boy I be make I use this chance tell una to follow and upvote!!

Sort:  

Very funny write up sha
Naija to the blood
welcome to steemit @biggijay

Boss me
I thank you!

Weldon with entry. I happy I see say steemit don bless you well.

I swear ehhh
E Don too change my life!!

Nice post, if you are interested in our whatsapp group chat
1: upvote this comment
2:follow me
3:reply yes to this comment
4:join our community of mutal upvoters
see u at the top: https://chat.whatsapp.com/2w7MBjGYh2I9Li4rg0EYHF

Ive followed.
Followe back

Sharp man, i greet you

I dey hail yu bak

Biggie i come that bet shop today, ah no see you.
Ask ena him see me

Na watin steemit don do for me be that ni
No too much bet shop ohh

Omo.. Na so so ur tori sweet soteh I dey taste sugar for mouth as I dey read am...
Omo yu na my home boy ooo...

Oboi me thank you ohhh
By Na @mritsnobigdeal For see me for bet9ja
If no be you

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.029
BTC 61182.87
ETH 3360.06
USDT 1.00
SBD 2.49