Naija Pidgin Challenge: Wetin Friendly Enemies Don Do Me

in #npc6 years ago

This is a view of Portharcourt rivers state, the treasure base of Nigeria..IMG_20180119_094252.jpg My people I hail all of una. I don dey see plenty plenty tori about friendly enemies so I come say make I drop my own. E neva too tay since this tin happen.
I bin meet the guy for one commot wey i go, him bin dey nice like one correct boy so me and him begin relate sharp sharp. We bin don dey talk for like 3 months before the broda invite me come hin house. I been no too reason am because him been neva give me any reason to. So we plan d day and when time reach I go d house. We been start to dey gist, hin offer me food and drink but I been chop before I come out so I no gree. Naso we start to dey watch movie and then uncle start to dey come closer to me, i no talk, then oga start to dey touch my laps, i come remove hin hand politely, images.jpgoga come put am back, i remove am again and move go and couch. Oga start to dey talk say make I no behave like pikin, say make we just do. I come tell am no, say infact I wan start to dey go house, hin come dey apologise and beg me make I stay. I agree and we continue d film. After small time hin enter kitchen bring juice for me, i tell an say I no want and hin start to dey insist, na then I begin dey suspect d drink. I tell am say I no want and I wan dey go my house, naso he hold me, throw me on d ground and start to dey force my trouser down. I start to dey fight am but hin power been too much. Hin succeed to pull my trouser down with my pant, then as hin been dey try remove his own short knicker, i see d glass cup with d juice, i carry am pour for d guy eye and as he been try to wipe am off, i knack d cup for him head. He come fall down and I carry the stool wey been dey knack am again for him head, naso I take run from the house ooimages.jpg!
Na my story be that o, d guy deceive me with fake good guy character but na wolf in sheep clothing him been dey all the time.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.029
BTC 61249.08
ETH 3397.67
USDT 1.00
SBD 2.51