Naija Pidgin Contest- My own steemit tory

in #npc7 years ago (edited)

2018-01-16 11.01.44.jpg
(a picture of deeper life road, Ashi, Ibadan)

I just dey scroll through my feed, na so I jam one post wey @prechi write. I first dey wonder weytin carry my guy dey yarn pidgin until I see say na @ogowinner dey do pidgin contest for we naija people. The thing sweet me as I read @prechi entry. @prechi con yarn me say me sef fit enter. I com ask myself, why me sef no fit enter the contest. Na so I com do my own entry oh.

20180116_105526.jpg

MY ENTRY

Dem talk say make we hala how steemit don helep us. For person like me that one no hard at all oh. Because say steemit don change my life like mad oh. I no really get tory to tell about ponzi schemes because say I no really lose money for anyone and I thank papa God for my luck. But because of how other people dey lose their money like play for them ponzi schemes, I first fear enter steemit. But when I see say I no need put money for steemit to start and because say na better person like @tojukaka carry steemit come meet me and halla me make I try the thing ,me sef no con dull oh.

Since I con join steemit everything don change for me. Though I never begin dey earn yanfu yanfu money like our ogas at the top (them whales and dolphins) but at least me sef I dey chop small small akara for here. Lol. I dey also get chance to dey use wetin I have get wetin I want. I dey fit write tory, poem and do other things wey I like to do. E dey always sweet me say other people dey appreciate my work, they com dey give me upvotes, dey comment on top am. Steemit no be only about the money oh but also about the love wey dey the platform because to me steemit na just love ontop blockchain.

Today I fit beat my chest talk say na better decision I make to join steemit oh. Because steemit don change my life. With all the awuf steem way I dey earn and all the sbd too. E be like say I no fit leave this steemit thing oh. Because say I be ordinary teenager wey no get chingba for hand before. Now steemit don turn me to small oga na master wey fit take care of himself. Na this one make me love steemit so tey I no fit leave lailai.

2018-01-16 10.59.29.jpg


I hope say you enjoy my tory wella wella. Them talk say make we capture picture of better Naija scenes and all the pictures for this post na weytin my yeye phone fit nab and edit be this oh.

Abeg no shy to qui-qui upvote this post for me. Abeg if you wan comment, make una comment for pidgin oh. No go kill my vibes. Make you no shy participate for the contest too oh

Na the link be this
https://steemit.com/npc/@ogoowinner/naija-pidgin-challenge-make-una-tell-us-why-una-like-steemit


Before I commot, make I sáré hail my country people. All them @tojukaka @ehiboss @prechi @amec @ewuoso @ogowinner and all my other country people wey dey do us proud for steemit.. I hale una oh.

Oya lemme comman be going


Remember say na your boy @ajremy
the teenager wey get yanfuyanfu steam for steem

Sort:  

Lol... Boss u just killed it.. E day ur blood Gan oo. Choi.. Ur own soft die

I just dey gentle jhor

U get the koko my brother

Na so we see am

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.17
JST 0.028
BTC 68641.27
ETH 2457.35
USDT 1.00
SBD 2.33