Friendly Enemies

in #npc7 years ago

Good morning to you my friends.

About the naija pidgin challenge wey dey shelemenge for steemit here, me self I get tori wey I wan yan o.


a7w3vz4ljz6rzuw2n594.jpg
credit

E don reach like six years wey me and may friend Sakiru sit down , we con decide say make we dey do business. But nah Sakiru dey get time pass because en no get work and me dey follow one lebanies company work and I dey get money. We con agree say me ago bring capital , say na en go dey manage our business.

We get many things wey we wan buy and my money no reach, I con organize contribution for my work , tell them say nah me go gather money first, and dem gree make I carry 1st. I con call sakiru, give am money wey dey my savings account make en take the money get shop ready because en say one agent tell am say one woman wan comot her shop if the month don end. Nah so I put mind say we don settle shop issue. Sakiru con tell me say en don pay the money give the agent and me self believe am because nah my very good friend.
The week wey con follow nah then I come gather contribution money, carry the money give am say make en go dey buy the materials wey we need small small for ground, me I dey think say pakam wey the woman comot shop like this, make we just pack enter.

Month con end, I con call Sakiru, en con tell me say the woman never pack, say she beg am make en wait one more week, me self com gree. One week com nack, I con ask Sakiru, en tell me say the woman never pack, nah like that three week nack o. I con vex one day , I con carry my red eyes go Sakiru house say nah dat day we go solve am, say the woman go pack.

As I reach Sakiru doormot, nah there dem tell me say Sakiru don travel go Dubai o.
Nah so I fall sick o.. because Sakiru don drain all my savings, nah 10 month I take return contribution money . no be small thing o.
Till I dey yan you this story, I never see Sakiru 4 naija o.


Thanks to @ogoowinner for bringing this challenge

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58665.29
ETH 2302.95
USDT 1.00
SBD 2.51