Friendly Enemy: hep me see dis madam

in #npc7 years ago

Na wa o. person just dey think how this steemit no wan show love, na so @ogoowinner just bless person with dis something.

O boi, una know how dis 9ja take be for December na, na so i go withdraw for ATM o, na like 8am I reach, by 10am, I still dey thr like mumu, never see money comot. Na so this madam show o, e be like say na she be d oga for d bank, dey there dey do conductor work for there.
atm-users.jpg
Me I know get wahala, d tin wey she dey do dey make person behave. Na so my turn reach o, I bin get like 2 ATM cards, u no go beleive say no one work.... I don dey for line for almost 3hrs, and cards no wan work?! I wan die!

Na so that madam wey I no get wahala with just come talk nonsense for my ear, talk say make I dey comot... 😲

I just look am, tell am say make she no even talk to me, make I mind my business. Na so I do am again... Na still nonsense the tin talk... o boi ye! Everybody for line come dey look me, I wan stone mumu for face. I come wait make another person run im own... e work out... wahala no dey, I come wan try again, na so madam come talk say I no fit... me, no fit? I tell am say as I never withdraw, my turn still dey kampe. Na im I chuk my card, na still nonsense I hear o. I just comot that place as na cry remain.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 59488.68
ETH 2538.17
USDT 1.00
SBD 2.52