My creed for life

in #npc7 years ago

images (26).jpg
E take me small time before I come start to dey take dis life with strong hand. For dis life, you no suppose just dey live am like say tomorrow no dey. This life na small world and people wey dey live inside am be like river wey go always meet one day. Because of that, make we always try do good for this life. Na wetin you plant put for ground nahim you go get back. Na because of this reason I come get some standards wey I dey live up to.

¶ If you chop alone, you go die alone so I believe say if you get power to help anybody, you try help person wey dey suffer for your side.

¶ I believe say na as you want make people treat you, na so you self go treat other people.

¶ I believe say this life wey we dey, na journey wey we suppose dey go jeje. No be race so make una no take am like competition.

¶ I go make sure say before I commot for this world, I go don make impact for people life so that dem go dey remember me if I don commot.

¶ I believe say na wetin you sow you go reap so I go always make sure say I do good.

¶ I believe say dis life na jeje so I go just take am simple

¶ I dey always put for mind say nothing for this earth dey impossible.

¶ I believe say no body too small so I dey make sure say I treat everybody well

¶ I no dey lie for the place wey I suppose talk true.

I KAREEM ADEOLA go follow all this tin wey I talk till baba God go call me.

MAKE BABA GOD HELP ME

DQmRKgYYp1TzWmvqtnfbMSLZQSgUXinUxqyHyd39HZ8j7gx.gif

Sort:  

I believe say nobody wey no fit to make am. God help us.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 61963.30
ETH 2416.68
USDT 1.00
SBD 2.67