RE: Naija Entertainment Artistes
In name na David adedeje adeleke but them know as well well to bi DAVIDO.
Him they write song and record producer.
Them born am for the month of november 21/1992.the CEO of DMW.him start hin music career with one music group wey them called KB international.him first track there be BACK WHEN.later him con sing one single for 2011 title am DAMI DURO that song en,egbe know bi small gbege e kos ooo.e waka like mad person
Why me like this dude be say him know because say him father get money make him sitdown know do any thing.they labish him father money.him still they they huzzle.him good for waiting him they do.him sabi sing and they drop weytin people they like.weytin make me like am again be say him they always spend big money for songs video.if unah go remember him shoot skelewu video reach 5times because say him won give better video.him get music agility and video swag.ok see.2017 him drop one song title IF that song waka all over the country,na the video again we won yan.that same 2017 him still drop another music wey them tittle am FALL wait ooo e never finish still that 2017 e still drop this one tittle FIA wey be say almost 100.000 people download am for just 2month that 2017 him.still drop LIKE DAT.and the four music waka every where.na me and davido for life.thank you @naijapidgin say unah bring this kind tin come out.
You like this man no be small. See the plenty thing you write about am