My blind date experience

in #naijapidgin7 years ago (edited)

IMG-20180506-WA0014.jpg
source
My friend Rita dey disturb me to get boyfriend again because me don been talk say I wan jus dey on a low key. I no wan friend any bobo because the last two relationship wey I enta before no favour me the first guy say I be good girl and na bad babes e like the other one. We just stop to dey talk without reason I know say I no good o but every human being get im own palava for body but as a fine girl guys dey always trip for me. Rita say make I change o say e don too tey at least make I give another guy chance I fit jam the better one sa make I see her now after all the mago mago when she don face for men hand she finally jam the better one.
IMG-20180506-WA0015.jpg
source
One day as I dey operate my lappy I con sight one website wen they connect people dem dey call am blind date you and person go chat and una go plan how una go meet. So, I con see one bobo wen I like, we connect con agree to see each other omo no be small tension o na so body dey shock me as if I never meet man before. The day con reach o everything set I don baff, wear cloth, arrange every every. One side of my mind dey tell me make I no go. What if na ritualist or kidnapper? Rita come say make I no fear say nothing dey happen I con gather mind enter taxi reach the place as I come down from taxi omo see shaking.

I enter the canteen sidon make una come see as omo girl dey sweat inside ac room as I dey wait one hand con touch me for my shoulder as I look up na one sweet guy the bobo kit up fine finish belle con dey sweet me say yes I don win jackpot. We greet each other, he sidon, them bring food, we dey chop, small time one guy wey be like imbecile with brown teeth and spit wen dey drop from him mouth just waka come sidon with us I say shuu for my mind who be this one. Na that fine bobo come yarn me say na my blind date be that na so all the worm for my belle start to fight before I know I start to vomit everywhere even for the guy cloth. See shame! I no just talk anything I run comot for the place sharp sharp.

Since then na im I don swear say I no dey do any blind date again cos e no go favour me.
As proverb talk am say them no dey talk say make pikin no grow long teeth for front so far e get mouth to take cover am

Na still your ogbonge babe @rosyblessing 👑
Sort:  

Wait o, I no too understand this your tory. Who come be that fine guy? Where him from come? And why tou no pour water for that other guy body sake of say he use another person picture deceive you because if naim real pic him use I no sure say you for comot house.

Lol, she was deceived I guess

wow nice post nice information about friends, best of luck

Congratulations @rosyblessing! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of comments received

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!

Coin Marketplace

STEEM 0.23
TRX 0.26
JST 0.039
BTC 96463.61
ETH 3397.54
USDT 1.00
SBD 3.22