#We Decide - State of Osun re-run

in #naijapidgin6 years ago (edited)

Na so power be o; who nor want em?

I dey lucky to dey among the 13 khaki people wey conduct rerun election for the Osun state rerun election, Ife-South LGA. My people, like 2baba being sing ram, nor be small thing o. Over 400 armed security personnel na him federal government deploy for our safety with top officials from our very own federal capital.
IMG_20180927_064528_590.jpg
The election, how him go? No thug, no fight (who them born well?), everywhere dey organized, over 10 news tori people being cover us sef -BBC with CNN follow come.

At last, nor be the man wey win the first round win the second one. No jubilation for streets as we sef see em.

People dey talk say them rig election. Khaki people nor sabi about that parole; wetin conzin us? Na our job we do and everybody see say we dey transparent finish.
IMG_20180927_063506.jpg
Like I being talk before, na the best I wish this state. Make God enter our leaders them belle.

Selah.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 56697.29
ETH 2390.51
USDT 1.00
SBD 2.29