Osun Decides #2018

in #naijapidgin6 years ago

images(2).jpeg

Na so we see em o; for this naija? election tori no be here.
Na serve them carry perzin go serve for osun state o inside one thick village like that near Ife where things dey happen for Osun. Hmm, wetin person eyes nor go see? My khaki, before me comot for house ehn, smooth like grass, no stain, nothing nothing - I wan go do fine bobo for my polling unit. But wetin happen? Na brown vest I wear come back house. Why? Una suppose dwun know. Boys them for that hood nor wan gree for us o. We do wetin them be say make we go do, everybori being dey cooperate but as them reason em say time dwun reach to scatter ground, these people nor gree carry last o.
images.jpeg
No be lie say them deploy policemen come protect us for our side but who them hep? Che them be sojo? Police leg sef nor touch ground before them tear race. But we thank God say person nor die o as na sojos come save us o. I dey tell you the kin beating way one thug chop for sojo people them hand ehn, me sef pity ram cos I dey sure say na hot water him woman go take mop him bori for weeks to come.
Anyways, na pray we dey pray for Osun, make Osun get leader wey go carry them go next levels and make all of us go fit gather talk say Osun dey Nigeria.
I want go sleep. As the tori dey shele for town here ehn, me go dey hola una

Sort:  

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 56688.84
ETH 2388.88
USDT 1.00
SBD 2.28