YOU FEEL SAY YOU FUNNY? THIS CONTEST NA FOR YOU

in #naijapidgin6 years ago

Ma pipu my pipu how una dey, I trowey salute give una oooooooo.
Make una all welcome to our ogbonge naijapidgin blog.

I greet una Happy Sunday o, nd aw weekend dey be for una side?
Another week don end and another don begin. Make una jex dey shakara dey go.
image
Wetin wan happen today like dis?
@naijapidgin don carry one ogbonge contest come ur domot. I no think say dis one be contest oo, bkos u go jex write shikini story win awoof.
Nawa ooo, @naijapidgin una dey try, I bow for una, bcos u still dey give awoof SBD for dis kind dry season, kudos to u.

Hmmmn, As d mata dey be, I know say d topic don dey hungry una....
Make una all cool down make we talk the rule of d game. Make una no joke wit our contest, bcos we no dey carry upvote do am.

Make I sharperly yarn d rule, topic go follow, plus rewards.
RULES

  1. Make una upvote dis post
  2. Resteem am
  3. U must don dey chat tey tey for we group no be today. If u neva join click here
  4. Ur entry suppose be at least 87% pidgin
  5. All words no suppose pass 100.
  6. Enter d contest
  7. If una no follow any of dis rule, make una jex forget d contest.

Hmmn, wetin be d contest self?
Before i yarn d topic, ur 100% creativity na im we need.
Topic
Just make us laugh in 100 words........
Shikini mata.

Before i commot
Make i yarn d reward attached
Most creative gets 1.5 SBD
More creative gets 1.0 SBD
Creative gets 0.5 SBD.
Na so dem say make i talk am ooo

As it go be: we go announce d winners for night for we blog on Wednesday.
Na the one wey make the admin them laugh tears comot for eyes go win.

Una good luck
Na @horlaide and @zizymena na im say make una play small.
image
Na @mittymartz na im design our avatar.

Sort:  

This one make sense o
This na why i dey gbadun una

Make i make u laugh in 100 words?
Just waka come like that, na the church way u wan go be that abi. Aproko no go kee you.
Ohk, i remember this funny talk way one of my lecturer talk.
We dey for one meeting, we student na so he con shout!
Dress well you girl!!!
'Stop dress like obanje' yeee
'Some of you dress like u are possed'
Jesu🙆
This one plenty for ear.
Na so one girl way be like mami water just walk in.
No laugh oo, na your laugh, abeg give me my laugh back.

Omo no be small thing oo, nothing wey steemit no go turn person to, I no say I go too read plenty comments today, all na hustle, man must survive... Hehehe..... after na, one yeye old man go come talk say we youth dey lazy, no be him fault, if toh say him dey steemit he for know say boys are not sleeping.

Happy Sunday my naija pipu. I hail ooo

Make I laugh una small

Na one teacher for primary school ask question say anybody wey know how many pipu Jesus fed with 2 fishes and 5 loaves of bread go collect two phones.
Naso one boy come answer am collect the phones. The teacher kon talk say make the boy ask him question make him collect the phones back.
Na him the boy say make the teacher mention all the names of the 5000 pipu Jesus fed.
Lol

For dis life I no dey believe say dream Na real becos I go sleep come dream say I get money come wake up with no money ...abeg make Pesin con sleep dream say him piss con wake up see showers of blessing for bed

I greet una say happy sunday o,make I make una laugh troway sadness

Na one lecturer enter class talk say dem get test make dem tear paper say na two questions e go be. Na im de lecturer start. Number 1,write una favourite food,naso all de ladies write shawarma,pizza etc, the boys dem write eba,fufu,amala etc. Na so the lecturer say number 2,make una write how dem dey prepare the food. Come see paper wey ladies tear change their food. Lol

na buhari I dey search for, I wish I can tear im face with slap, shey e talk am say the youth dey very lazy, I no fit blame am, na bcos the ac wey dey blow for im house Don blowaway all his common sense. Yusuf dey asorock dey enjoy, y buhari no fit push am for street and define laziness....

Sebi dem say If you dey sell cloth, you suppose dey wear better cloth. Make dem no say, Yes na cloth you dey deal with.

I check all the comment for here con see one guy wey dey sell upvote. The guy dey reputation 25, with $0.03 as payouts. Abeg, shey na joke be that one?


I for make una laugh this morning, but, I dey vex. Na since day before yesterday I dey expect light, dem con finally bring am come for midnight o. I cool down chat wella with hope say I go plug my phone con sleep.

I wake up this morning con see low battery.
My people, I forget to on socket, I just plug the phone go sleep and NEPA don carry light.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Why be say baby everytime wey rain fall na him we dey drink tea? we dry copy copy our European people sote even for hot sun, some area boy still Fey smoke ganja, I dey hail o, as buhari say una youth nor ge work, anybody wet wan weed my farm for free?

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 62934.09
ETH 3118.65
USDT 1.00
SBD 3.85