YANKE MONEY PALAVA

in #naijapidgin6 years ago

oaEY5Y9.jpg
Naija una well done o
How una dey hold body for this SBD saga

Naija pidgin don carry another ogbonge mata come come today!

Una know say some people wey dey live for yanke dey struggle to make money
Some of them they wash plate, while some na driver work dem dey do.
Some no kuku get papers, dem dey hide up and down, make their Government no catch them.
The thing be say, Life for yanke no easy at all.

But some of these people wey don suffer to make this money, go come back naija dey spend am anyhow to show everybody say them come from yanke.
but e still get good ones wey dey use the money do investment, build house or start company.

So i dey bus yesterday, one lady wey dey my back just dey make call dey shout,
E be like say e no too tey wey she come back from yanki
She dey send money give her sister wey dey naija to help her build house
but from the call wey she make, she go the house, come see another person wey they renovate the house
She come find out say her sister sell the house.

The sister no even know how the lady they suffer to make money,
She just sell house carry the money go.
The lady no know wetin to do, if na person wey no be her sister, e for easy to deal with am.
But as this one be her sister, she no know where to start

Naija pidgin make una help me reason the mata,
If na you wetin you go do?
Wetin una dey advise the lady make she do?

make una chook mouth for this matter for comment section

We get whatsapp group where everything dey happen, if no dey join here

Na @nmalove carry this matter come

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar

Sort:  

Hmmm this mata serious o. Make i just yarn the truth. Una know say blood is thicker than water. So, as it take be say na em sister wey dey involve, e go hard make she get that money back because, na because say na em blood, na em make em get mind givam the money before to build. For my side, the money don go be that. Em no go get mind deal with em sister at all. Em fit call am police sef if say em seeam, but na em go still carry em hand bail am because of sister love. Na Blood matter be that my people. Em sister know how e go take be, say em sister no go do am anything. Na the thing

Hmmmmm.... E don happen, e don happen!!!
The money don go already. Even if she kill her sister self, the money no go come out.
She gat forgive her sister o.

I know say e no easy at all but na blood we dey talk here. God go give her grace to forgive her sister and also restore all the things wey she don loose in double. Amen

Chia that na wickedness ooo... But Watin man go do? She go need to start life again ooo

Shey the sister wey sell the house disappear ni abi she travel?

Ehn.. Make she go meet her na. Any amount she spend the money reach, make she collect am with slap.

If the sister self dey plan to build house with the money or she don get one big shop, make she collect am, if she no gree, then, police na the next thing.

Gbam.

U know ehn sometimes it dey trip me d way some ppl go just do some things to their family and na their kind go dey talk go dey Para if u no give them something as for dis matter ooo if na me for d fact sey she fit do me like dat although na my sister it mean sey she no see me as brother so me self go handle d matter like sey na outsider

Hmmmm. Firstly the woman get fault everybody know say people fit dey desperate at times. The thing wey she suppose do be say make she tell that her sister to find agent wey dey into building make she con be the supervisor, and even if she don find the agent she go still do correct background check the person real. Na the person she go dey send money to, her sister own na to supervise.
Now wey the sister Don do like that she no fit do anything. She go leave the matter for God

Una well done ooo @naijapidgin😁

I confuse for this matter o
I no sure e get as dem fit catch the sister o
My own be say make she forget the money cis as e be so she no go get am back

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.031
BTC 63047.55
ETH 2690.45
USDT 1.00
SBD 2.54