Under age mama

in #naijapidgin โ€ข 6 years ago

๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹๐Ÿ‘‹
My naija pipu,correct pipu, correct pals, hw una side.
Hw una weekend dey take be, hope say unah enjoy d free day wey dey the week sha..

JPEG_20180518_163148.jpg

@naijapidgin talk say make i salute nd grit all of unah "good morning " say im dey wish u a stress free week days ahead
How hustle, hope say na pray n work u dey carri do all dis level l. We pray say all go sama well soonest.

D mata wey come our domot today na one kain serious mata wey we no observe. It don tey wey dis thing don dey disturb ma mind,if we check enviroment today, we dey see say na small pikin dey carry pregnancy most for dis atmosphere. I come term dis as 'Teen Natality'.

Wetin be TEEN NATALITY?
Teen Natality wey we also know as teen child birth, wey be say person wey neva pass age nineteen (19) go dey get pregnancy. Hmmn, country pipu, everywhere don spoil, population and poverty don dey work hands in hands.

Effect wey Teen Natality don cause:

Dem go misss several opportunities base on child bearing Dem fit no get opportunity to attend school peer pressure Too much pipu for population In some cases, dem fit lose their lifes.

As d mata don be, dis early child birth as far as naija dey concern no go at all.
Case study to be my environment: all dis child birth of a thing don lead to intense poverty, depression for d victim mind and for some cases stigmatization from relatives.

My naija pipu, hw una take reason dis mata.
Wetin we see for dis teen child birth of a thing.

no forget to d support us with your upvote and resteem.

join us for our discord server here

nah @holiard bring this one for us

nah @mittymartz give us this avarta.

IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort: ย 

Na lack of upbringing dey cause all this. When some parents sef no value education for their children. Dem no go school,so dem no want theie own children too.
Some parent dem like social outing wey dem no dey get time for children too dey cause am
Children go dey do something,dem no go check weda e good abi e bad.

Me i think say na poverty de cause this things , na money dem de use deceive those pikin

so nah em b say if plenty money dey people no go dey do dis things

To me I go say na lack of knowledge wey our parents or guidance dey get dey follow cause am.
Dem no know say early marriage dey cause big wahala fir the girl health. Both physically, mentally, socially and emotionally.
Even sef the girl fit get wahala of the viganal in the process way she wants born.

Also love of money and poverty dey cause am.
Our parents or guidance no dey consider anything as long as money dey involve. Then own na make them get the money.

But if our parents or guidance go get knowledge about the thing. I think from their the rate go reduce. And also may government dey educate people and put law for ground to secure the health and life of our young girls.

Una gud morning.

my person u don yarn well

Smiles..
๐Ÿ‘๐Ÿ‘๐Ÿ‘

ย 6 years agoย (edited)

Actually na dey way naija take sit down na hin we go look am..naija na country wey oppression fit make man kill him self...You see now make we really check matters you go see say no be actually them dis shenkes wish to get belle or anything but....work no dey for thier parents and last last peer pressure....my friend dey wear fyn fyn things...and my father no get money gimme...and most times again @naijapidgin you know say our mama them to dey fall hands well well dem suppose lecture dis girls dem on how matters de be so as to prevent all dis kind thing's dem...e get wan time wey me nd my mama dey talk she bin let me kwn say during her time her mama tell her say if she near man or even shake man she go get belle only that thing make she no leave life like some of her mate....to eradicate this matter we go need start from house our mama them need to work better work self @naijapidgin na my contributete be this una good morning ge!!!!!

you don yarn well

Illiteracy, poverty, lack of sense, greed, lust, wickedness, hatred, etc.
All join dey cause this kin tin especially when the parents just no sabii anytin

okay we thank you say you put mouth for this matter

To me na illiteracy dey cause am and chidren of nowadays no dey hear word dey wan flex, may God help us all

Na lack of sex education and parental education on sex too with poverty na im dey cause all this teenage pregnancy me no support am o becos e dey increase poverty and rate of crimes too

Everybody wey talk don talk well. Social media and wetin dem dey watch for tv dey cause am too. When all these small pikin don watch korea drama finish, dem go con dey find the kind love wey dem see for tele. And we sabi say our bros for our naija society no dey dull, dem go just pick dem hammer dem belle. The thing dey always pepe me for body and dem pikin no dey wan learn, teenage laulau wey oyinbo people dey call exorbitance go dey shack dem.

Teen natality na wetin we dey call "aru" for my language. No be good thing at all, but as bad as e be sha when such things happen, i always de talk say make dey girl born de pikin instead of to go do abortion. @naijapidgin i just hope say i talk una mind....we go meet later

My own be say papa and mama dem go do their work well we'll, wen the pikin dey small dey suppose teach am well well about sex education. Dey no suppose shy, dem go point hand for bodi and show dem wetin dem dey use all parts of the body do, if dey no do am another person go teach dem bad thing. Another one be say dem go check the friends wey their pikin dey follow, talk don finish for my month ooo but before I got ehh papa and mama dem go try lead by example, pikin this days dem practice wetin their mama and Papa dey do. Na your brother @theheralds dey talk so.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.17
JST 0.029
BTC 69585.15
ETH 2499.56
USDT 1.00
SBD 2.56